34
Moses Die
Den Moses komot from Moab Wildaness kon go Mount Nebo until e rish on-top Pisgah mountin, opposite Jeriko. God show am all di land from Gilead go rish Dan, plus Naftali Efraim, Manasseh and all Judah land go rish di sea for far. God show am Negev and di valley for Jeriko; di town wey get palm tree and Zoar land. Den God tell Moses, “Dis na di land wey I promise Abraham, Isaak and Jakob wen I sey, ‘I go give dis land to yor shidren-shidren.’ I don let yu si am, but yu nor go cross enter.”
So Moses wey bi God savant kon die for Moab land, just as God bin tok. God beri am for Moab land near Bet-Peor, but kon rish today, nobody fit sey, “Na here or na der God beri Moses put.” Moses na one hundred and twenty years wen e die, but en eye still klear and e still strong like yong boy. Israel pipol mourn for Moses for thirty days inside Moab wildaness; den dem kon stop to mourn for Moses.
Joshua Take-ova
Naw, Nun pikin, Joshua get wisdom well-well, bikos Moses don pray for am. So Israel pipol dey obey Joshua and dey do God kommand wey E give dem thru Moses.
10 E nor ever get any oda profet for Israel wey bi like Moses, wey si God face-to-face. 11 God send am go do many signs and wonders for di king for Egypt, en ofisas and for di whole land. 12 E nor get any oda profet wey don fit do all di strong and mighty tins wey Moses do for Israel pipol present.