4
Make Una Dey Obey
Israel pipol, make una listin to di rules and law wey I won tish una naw. Make una obey dis law, so dat una go get betta life kon enter and stay di land wey awa grand-grand papa God promise sey E go give us. Make una nor add join or remove from dis kommand wey I dey give una. Make una just obey di Oga una God kommand wey I dey give una. All of una si wetin God do for Baal-Peor. How E distroy di pipol wey serve juju for der. But all of una wey dey faithful to God still dey alive till today. Si! I don tish una di rules and law, just as God tell mi, so dat una go dey do dem for di land wey una won enter go stay. So make una dey sure sey una dey do dem, bikos dis tins go show how una get sense rish among di pipol wey go hear am and dem go sey, “True-true, dis great kountry get pipol wey wise well-well.” In-short, e nor get any oda kountry wey dia gods dey klose to dem like di Oga awa God wey dey ansa wen ever wi koll am. Na wish oda great kountry get rules and law like di ones wey I tell una today?
But make una look well! Make una dey kareful, so dat una nor go forget wetin una don take una eyes si. As long as una dey life, make una nor let dis tins komot from una mind! Make una make sure sey una tell una shidren and grand-shidren about dis tins. 10 Make una nor forget di day wey una stand before di Oga una God for Mount Horeb where E for tell mi sey, “Gada all di pipol kom meet mi, so dat I go tell dem my kommand. Den dem go learn to dey fear mi as long as dem dey alive and dem go tish dia shidren to dey fear mi too.” 11 Una waka kom stand near di mountin as di smoke from di mountin dey shot enter sky, but di mountin dark, bikos of di tick kloud. 12 Den God tok to una from inside di fire. Una hear pesin dey tok, but una nor si anytin. 13 E give una en kovenant. E kommand sey make una dey obey di ten kommandment wey dem rite for two stone. 14 Na den God kommand mi sey, make I tish una dis rules and law, so dat una go obey dem for di land wey una won enter go stay.
As Israel God Bi
15 But make una dey kareful, bikos una nor know as God bi even wen E dey tok to una for Mount Sinai from inside di fire. 16 I dey tok like dis, so dat una nor go make juju kon kause wahala for unasef. Dis mean sey weda di juju bi like man or woman, 17 any animal, bird wey dey fly, 18 anytin wey dey crawl for groun or any fish for wota. 19 Wen una look di sky kon si di sun, moon and stars and as evritin bi for heaven, make una nor let anytin move una to woship or serve dem, bikos di Oga una God don give dem to di pipol for di eart. 20 Make una remember sey di Oga wey bi una God, save and take una komot from Egypt, so dat una go bi en own pipol wey E go guide and na so una bi till today. 21 But God dey vex for mi, bikos of una and E swear sey I nor go ever cross Jordan River or enter di good land wey E go soon give us. 22 So I must die for dis land; I nor go cross Jordan River. But una go cross ova kon take di land wey God promise us. 23 So make una dey kareful, so dat una nor go break di kovenant wey una make with di Oga una God. Make una nor make any juju for unasef, bikos una God nor like am. 24 Di Oga una God na strong fire wey dey burn anytin and E dey jealous well-well. 25 Afta una don born shidren and grand-shidren and una don tey for di land well-well, if una spoil unasef kon make juju and do yeye tins wey go make una Oga God vex, 26 I koll heaven and eart as witness today against una. If una break di kommand wey God give una thru mi, una go die for di land wey una won cross Jordan River enter. Una go stay der small; den God go distroy una finish. 27 God go skata una among di pipol and una nor go many for di kountries wey God go drive una go. 28 For der, una go woship gods wey pesin take hand make; wood and stones wey nor go ever fit si, hear, chop or smell. 29 But if una turn to God from der, E go kom help una, dat na if una really turn kom meet am with all una heart and soul. 30 For dat time, wen una dey trobol and all dis tins don happen to una, una go turn kom meet di Oga una God kon obey all en kommand 31 (bikos E dey sorry for pipol), E nor go let una fall or distroy una, bikos E nor fit forget di kovenant wey E make with una grand-grand papa dem.
Si As God Good Rish
32 True-true, make una look as e bi before, from di time wey God kreate pipol for dis eart kon rish naw and una look from where di heaven start go rish di end, anytin wey dey great like dis don ever happen or sey pipol si am before? 33 Any kountry don ever hear God vois dey tok to dem from inside fire as una hear kon survive to tell pipol about am? 34 Or God don ever try to diliver one kountry from anoda kountry with judgement, signs, wonders, war, strent, pawa or any oda tin wey dey make pesin fear like di ones wey God do for Egypt for una own eyes? 35 E show una dis tins, so dat una go know sey na di Oga God bi God and no oda pesin or tin, big rish am. 36 E let una hear en vois from heaven, so dat E go fit tell una wetin una go do. E make una si en great fire for eart here, so dat E go tok to una from der. 37 Bikos E love una grand-grand papa, E kon choose to bless dia shidren-shidren and na en own hand E take komot una from Egypt with all di wonders wey E do. 38 E porshu kountries wey strong pass una komot from dia land, so dat una go fit take di land kon stay der forever. 39 So make una remember dis tins kon keep am well for una heart: Na di Oga God bi God, both for heaven and for eart and know oda god, dey. 40 If una obey all di laws and kommand wey I dey give una today, e go betta for una and una shidren. I dey give una dis kommand, so dat una go get long life for di land wey di Oga una God dey give una forever.
Town For Jordan River
41 Den Moses selet three town for Jordan River east. 42 Anybody wey by mistake kill pesin wen e bi sey dem nor get wahala or kworel before, fit run go one for dis towns and e go dey save. 43 Dis towns na: Beza wey dey di wildaness high land for Reuben tribe; Ramot for Gilead wey bi Gad tribe own and Golan for Bashan wey bi Manasseh tribe own.
Di Kovenant
44 Dis na di law wey Moses give Israel pipol. 45 All dis na di law, rules and kommand wey Moses tell Israel pipol afta e don lead dem komot from Egypt 46 and as dem dey kamp for di valley near Bet-Peor wey dey east for Jordan River. (Amor pipol wey dia king bi Sihon wey bin rule form Heshbon, na dem get dis place before. But Moses and Israel pipol kom from Egypt kon distroy di king and en pipol. 47 Israel pipol take di land and King Og for Bashan own too and na di two kings for Amor get am. 48 So Israel pipol take all di aria wey dey for Aroer near Arnon Gorge go rish Mount Sion, wey dem still dey koll Mount Hermon. 49 Israel pipol still win all di wotaside for Jordan River east go rish di sout for di Deat Sea, under Pisgah aria.)