5
Di Kovenant For Mount Sinai
Den Moses koll Israel pipol kon sey:
“Make una listin well-well to all di law and rules wey I dey give una today, so dat una go learn and obey dem! Di Oga awa God make kovenant with us for Mount Sinai. E nor make dis kovenant with awa grand-grand papa dem, but na with all of us wey dey alive today. God tok to us face-to-face for di mountin from inside fire. (Dat time I stand between God and una, so dat I go tell una God message, bikos una dey fear di fire, so una nor fit klimb di mountin.)”
Di Ten Kommandment
God sey, “Na mi bi di Oga wey bi una God, di One wey take una komot from Egypt where una for bi slave.
Make una nor serve any oda god escept mi.
Make una nor make any juju with anytin wey dey heaven; eart or for inside wota. Make una nor woship or serve dem, bikos mi wey bi una God dey jealous well-well. I go ponish una shidren and shidren-shidren for di sin wey dia papa kommit, 10 but I go show my mesi thru di kovenant to doz wey choose, obey and keep my kommand.
11 Make una nor use di Oga una God name take make yeye, bikos God nor go sorry for anybody wey use en name anyhow.
12 Una must obey di Sabat Day, just as di Oga una God kommand una. 13 Una fit work and do evritin wey una won do for six days, 14 but for di sevent day, una must nor do any work. Dis mean sey, both unasef, una shidren, una savants, una animals or di strenjas wey dey with una, evribody must rest for dat day. 15 Remember sey una bi savant for Egypt and na di Oga una God take una komot der with en strong pawa. Na dis make God sey make una dey keep di Sabat Day.
16 Make una honor una papa and mama, just as di Oga una God don kommand una, so dat una go get long life and e go dey well with una for di land wey E won give una.
17 Make una nor kill.
18 Make una nor sleep with who nor bi una husband or wife.
19 Make una nor tif.
20 Make una nor lie for pesin head.
21 Make una nor dey like anoda pesin wife or husband, or sey yu like to take pesin house, land, savants, animal or any oda tin.”
Sinai Vishon
22 God tell una dis tins from inside di fire as una gada for di mountin. E shaut tok from di fire wey kloud and darkness kover. Dis na all di tins wey E tok dat time and E rite dem for two stones kon give dem to mi.
23 But wen una hear en vois from di tick darkness as di mountin dey katch fire, all di eldas and leaders for una tribes kom meet mi. 24 Dem kon sey, “Di Oga awa God don show us as en glory big rish and wi don hear am tok from inside di fire. Naw wi don know sey God fit tok to human being and dem go still dey alive. 25 But naw, why wi go won die again? Bikos if di Oga awa God tok to us again, den wi go really die! If wi kontinue to dey hear awa Oga God vois, wi go die! 26 E get anybody for dis whole world wey hear God vois from inside fire as wi hear am kon still dey alive like us? 27 Make una go by unasef kon listin to wetin God dey tok. Den make una kon tell us evritin wey E tell una and wi go listin and obey.”
28 Wen God hear una dey tok to mi, E kon tell mi sey, “I hear wetin di pipol tell yu and dem tok well. 29 If to sey dem go just gri fear mi and obey all my kommand, e for dey well with dem and dia shidren-shidren forever.
30 “So make yu go tell dem, ‘Make dem go back to dia house!’ 31 But make yu nor follow dem go, yu go dey here with mi, so dat I go fit tell yu all di kommand, rules and law wey yu go tish dem, so dat dem go dey do dem for di land wey I go give dem.”
32 So make una dey kareful kon do as di Oga una God kommand; make una nor turn go rite or left! 33 Make una dey do just as E kommand una, so dat una nor go die; evritin go dey well with una and una go stay long for di land wey una dey go.