6
Dis na di kommandment, statutes and ordinances wey Oga God give mi make I tish una and una must obey and do dem for di land where una dey go. Una go make sure sey una respet Oga God and obey all en statutes and kommandments wey I dey give una – una, una shidren and grand-shidren – go obey am with all una life so dat una go get long life. Make una pay attenshon, Israel pipol, and dey kareful to do dis, so dat una go stay well kon plenty more-more – as God, una papa-papa Oga tell una and una go inherit di land where milk and honey plenty well-well.
Di Kommandment Wey Big Pass
Di Kovenant Law
Israel pipol! Make una listin! Di Oga na awa God and God na one! So una must love di Oga una God with all una heart, all una soul and all una pawa.
Make Una Tish Odas Di Kovenant
Dis word wey I dey kommand una about today so, una must keep am for una mind and una must tish una shidren kon tok about am as una sidan for house; dey waka for road; dey sleep or wen una wake-up. Make una tie dem for una hand kon wear dem for una fore head, so dat una go dey remember dem. Make una write dem for una gate and door-mot.
Woship God
10 Den wen di Oga una God take una enter di land wey E promise una grand-grand papa, Abraham, Isaak and Jakob sey E go give una; di land wey get big and fine-fine towns wey una nor build at-all 11 and house where betta tins full, tins wey una nor buy with una hand. For di land, una go fetch wota from well wey una nor dig and una go chop from vineyards and olive trees wey una nor plant, 12 so make una dey kareful, so dat una nor go forget God wey take una komot Egypt.
13 Una must fear di Oga una God kon serve am. Una must use only en name take swear. 14 Una must nor woship any of una neighbour gods apart from God ensef, 15 bikos di Oga una God wey dey here with una, dey jealous well-well and en vexnashon go kill and porshu evry oda tin, until E go distroy wiked pipol and sinnas komot from dis eart.
Make Una Obey God
16 Make una nor test di Oga una God, just as una do wen una dey for Massah. 17 Make una make sure sey una dey obey dis kommand well kon keep all di laws wey E give una. 18 Make una always dey do wetin dey rite and good for God eye, so dat evritin go dey well with una, den una go enter and stay for di good land wey God promise sey E go give una grand-grand papa. 19 Just as God sey make una do, all di enemies wey dey stay der, una go porshu dem komot.
Remember Wetin Happen Before
20 Tumoro wen una shidren go ask una sey, “Dis law, kommand and rules wey di Oga awa God give us, wetin dem mean?” 21 Den una go tell dem, “Wi bin dey Egypt as Fero slaves, but God take us komot from Egypt with en own strong hand. 22 God do many mirakle, signs and wonders for awa front, bikos E kause betta wahala for Egypt, Fero and en pipol. 23 E take us komot from Egypt, so dat E go give us dis land wey E don promise awa grand-grand papa. 24 Na di Oga awa God kommand us to obey and fear all en kommand, so dat E go kontinue to bless and guide awa life, as E dey do since kon rish today. 25 Wi go dey good for en eye if wi obey all dis kommand wey di Oga awa God give us.”