7
Pipol Wey God Choose
Wen di Oga una God take una enter di land wey una go-go stay, E go porshu many kountries komot for una. Kontries like: Hit, Girgash, Amor, Kanaan, Periz, Hiv and Jebus pipol. (Di pipol for dis seven kountries get pawa pass una.) Wen di Oga una God don give dis kountry to una and una don konker dem, una must distroy dem finish. Make una nor enter agriment with dem. Make una nor even marry from dem. Make una nor let una pikin marry dia pikin, bikos dem go take una shidren from mi kon let dem go woship anoda god. Den God go vex for una well-well kon kwik distroy una. Dis na wetin una go do. Una must skata di pagans altar kon distroy all dia juju pilas. Make una kut dia Asherah pole for groun kon burn dia juju. Bikos una dey holy and na di Oga una God bi una papa. From all di pipol wey dey di eart, di Oga una God don choose una to bi en own special pipol.
God nor choose una from en heart, bikos una plenty pass oda kountries or small pass oda kountries! But na bikos God love una and dey keep di promise wey E make with una grand-grand papa. Na dis make God save una with en strong hand wen una dey serve as slave for King Fero hand for Egypt. So make una undastand sey, di Oga una God na en really bi God. Na en bi di God wey dey keep en kovenant for tazon generashon kon dey show en love wey nor dey end to doz wey love and dey obey en kommand.
10 But E nor dey waste time to ponish and distroy doz wey rijet am. 11 So una must obey all dis kommand, law and rules wey I dey give una today.
Betta Promise
12 If una listin to dis rules kon obey dem with all una heart, di Oga una God go really keep en kovenant wey E promise una grand-grand papa. 13 E go love and bless una kon make una plenty and E go give una many shidren. E go bless evritin wey una plant and una animals. Wen una rish di land wey E promise sey E go give una grand-grand papa, una go harvest many korn, new wine, olive oil and many kattle, sheep and goats. 14 For all di kountries for di eart, na una God go bless pass. Evry man and woman among una go get shidren and una animals go dey born too. 15 God go protet una from any kind sickness. E nor go let una sofa from di bad-bad diziz wey una si for Egypt, but E go make una enemies sofa dis diziz! 16 All di kountries wey di Oga una God dey give una, una must distroy all of dem finish. Make una nor sorry for dem at-all and make una nor woship dia gods, if not dem go trap una.
17 Una fit tink and ask, “Dis kountries many pass us, so how wi go take distroy dem?” 18 Make una nor fear. Make una remember wetin di Oga una God do to Fero and Egypt pipol; 19 di betta judgement wey una si, di signs and wonders wey God do; en strent and pawa wey E use take-take us komot der and na so di Oga una God go do to all dis pipol wey una dey fear. 20 Den di Oga una God go send fear go porshu doz wey neva die wey dey hide and E go do am until di very last one wey dey hide from una, go die! 21 So make una nor fear doz kountries, bikos di Oga una God dey with una and E bi God wey dey great and wonderful. 22 Di Oga una God go-go for una front and na small-small E go take porshu doz pipol komot di land for una, until dem go finish. E nor go porshu all of dem at wons, if not wild animals go kon too kwik plenty for di land before una rish der. 23 Di Oga una God go give dem to una; E go make dem fear well-well until una go distroy dem finish. 24 E go put dia kings for una hand and una go remove dia names from dis eart. Nobody go fit fight una and una go distroy all of dem. 25 Una go burn dia juju for fire and una must nor like dia gold or silva. Una must nor take dem, if not dem go bi trap for una, bikos dem nor dey good to di Oga una God. 26 Any propaty wey God nor like, make una nor take am enter una house, bikos if una do so, God go distroy una just as E do to doz pipol. Make una make sure sey una nor do dat kind tin, bikos God go distroy dem.