15
Elifaz Tok Again
Den Elifaz wey kom from Teman kon tell Job:
“Pesin wey get sense dey tok anyhow?
Abi di east wind fit make am beleful?
No wise pesin go tok as yu dey tok so
or sey en dey rite with en yeye words?
Yu nor dey fear God?
Yu nor dey respet am at-all?
Na yor sin dey kontrol yor mout
and na yeye words yu choose to tok.
E nor get any nid for mi to kondemn yu;
bikos only yor words don kondemn yu.
Na yu bi di first man wey dem born?
Dem don born yu before God kreate di mountins?
Yu dey hear di plans wey God dey make?
Na only yu get human being sense?
Wetin yu tink sey yu know wey wi nor know?
Wetin yu feel sey yu undastand,
wey wi nor undastand?
10 Wi learn and get awa sense from old pipol;
pipol wey dem born before yor papa.
11 God konfort too small for yu?
Abi en gentol words nor rish for yu?
12 Wetin make yu nor dey rizin well again?
Wetin make yor eyes dey weak,
13 sotey yu dey tok all dis kind words,
bikos yu dey vex for God?
14 Any human being fit dey klean?
Anybody fit dey rite before God?
15 God nor even bilive en own angels,
bikos dem nor klean rish for en eye,
16 how E won take bilive man wey dey drink bad
and wiked tins like wota?
17 If yu go gri listin, I go esplain give yu.
I go ansa yu from wetin I know.
18 Pipol wey get sense don tish mi trut
wey dem learn from dia papa;
19 doz wey God give di land
before any strenja kon stay with dem.
20 Wiked pipol go sofa ponishment as long as dem dey dis eart.
Na pains go full dia years for dis world.
21 Vois wey dey make pesin fear nor go leave dia ear
and where dem feel sey dem dey save, tif go kom meet dem for der.
22 Dem nor get hope to kom out from darkness,
bikos swod dey wait to kill dem trowey.
23 Dem dey waka anyhow dey find food.
Dem know sey di day wey God go distroy dem don near.
24 Just like wen strong king dey wait to attack en enemies,
na so too fear and pain dey make dem shake,
25 bikos dem dey tok to God anyhow,
dey make mout for di Oga wey dey mighty.
26 Dem hold dia strong swod
dey won fight di Oga God.
27 Dis wiked pipol big and dem dey prosper;
dia waist fat well-well too.
28 But dia towns go skata.
Dem go stay for abandon house wey don near skata.
29 Dia money nor go tey for dia hand
and nor-tin wey dem get, go last.
Even dia propaty go finish.
30 Dem nor go fit run from darkness;
dem go bi like tree wey en branches don burn finish
and dem go skata as God breath.
31 If dem nor get sense rish
and dem kon dey bilive bad tins,
na di bad tins go follow dem.
32 Dem go die finish before dia time go rish den dia branches
nor go ever green again for life.
33 Dem go bi like tree wey dem kwik plok en fruits;
like olive tree wey lost en beauti.
34 Doz wey nor dey fear God nor go get anytin at-all
and na fire go burn di house
wey dem build with wayo money.
35 Dis na di pipol wey plan trobol and born wikedness. Na lie full dia belle.”