16
Job Ansa Elifaz
Job ansa:
“I don hear many words like dis before.
Yor konfort na more trobol for mi!
All dis yeye word wey yu dey tok neva taya yu?
Wetin make yu still dey ansa mi?
If na yu dey face wetin I dey face so;
true-true, I go tok di same tin wey yu dey tok.
I go shake my head kon tok against yu.
But fit to sey na mi I for enkourage yu.
I go try reduce yor pains.
God And Man Don Leave Mi
“But e nor get wetin I go tok give yu,
wey fit help mi and even if I kwayet,
e nor go remove my pains.
My Oga God, true-true, Yu don kill my full family
and Yu don make life taya mi.
Yu don seize and turn mi to yor enemy.
Na skin and bone I bi
and pipol dey use am against mi.
God don skata mi, bikos E dey vex.
E tear mi with en tit
and dey look mi one kind.
10 Pipol dey curse and laf mi.
Dem dey slap mi for face
and dem don gada against mi.
11 God don karry mi give wiked pipol.
E don put mi for evil men hand.
12 I dey live for peace before,
but God don skata mi.
E seize mi for my neck kon skata my life.
E dey plan against mi.
13 E dey shot mi with en arrow from difren direcshon.
E nor sorry for mi wen E dey wound mi
and na my blood wet di groun.
14 E wound mi many times.
E attack mi like soja wey hate pesin.
15 I dey mourn with sak klot
and I use san take kover my face.
16 I kry sotey my eyes don dey red
and swell-up and naw,
na only darkness I dey si.
17 I dey pray to God from my heart,
bikos I know sey I nor do any bad tin.
God Na My Witness
18 “Dis groun, na beg I dey beg yu,
make yu nor kover di bad tins wey dey happen to mi;
nor kwayet naw wen I dey kry for help!
19 I know sey pesin dey for heaven
wey go stand fight for mi.
20 My friends dey tok against mi
and I dey kry give God.
21 Abeg, I nid pesin wey go help mi beg God,
just as pesin dey beg en friend.
22 My years nor plenty again
and I go soon go where I nor go fit kom back again.