19
Job Ansa Bildad
Job ansa:
“Bildad, na wen yu go stop to ponish
and worry mi with yor words?
Yu don already curse mi rish ten times.
Yu suppose to dey shame as yu dey trit mi like dis.
Even if I do bad tin,
how dat one take koncern yu?
If yu feel sey yu betta pass mi
kon dey use my trobol against mi,
den make yu know sey na God handwork bi dis,
bikos na-im set trap wey katch mi so.
Job Sofa
“If I kry out bikos of dis trobol sef, nobody go ansa mi.
I dey kry for help, but nobody dey hear am.
God don block my way and I nor fit pass;
E don hide my way for darkness.
E don take all my glory
kon distroy my respet.
10 E skata mi for evry side,
until I nor get hope again.
11 God dey vex for mi,
so E kount mi join en enemies.
12 En sojas kom attack mi;
dem skata my life kon build dia kamp round my house.
Life Taya Job
13 “God don make my family far from mi;
I don turn strenja to pipol wey know mi.
14 My family don go leave mi.
My friends don forget mi.
15 Even di strenjas for my house don forget mi
and my wimen savant dey do like sey na mi bi strenja.
16 Wen I koll my savant, e nor gri ansa,
even wen I beg am with my own mout.
17 My wife nor fit stay where I dey breath
and my own broda nor gri kom near mi.
18 Shidren sef dey laf wen dem si mi.
Wen I won tok, dem go turn waka leave mi.
19 My klose friends dey look mi with shame
and di ones wey I love, don turn against mi.
20 My bones just whole my skin
and I just manage dey run with my life.
21 Una wey bi my friends!
Make una sorry for mi naw,
bikos God don nak mi fall with en hand.
22 Why yu dey porshu mi, just as God dey porshu mi?
Abi yu neva trobol mi rish?
Job Bilive Sey God Go Save am
23 “I for like sey somebody go remember all wetin I dey tok,
make e for rite dem for book!
24 Or make e karve and rite di words for stone,
so dat dem go dey forever.
25 But I know sey God dey for heaven
and E go kom save mi for di end.
26 Even wen sickness don chop my skin,
as I still dey dis body, I go si God.
27 I go si am with my eye
and E nor go bi anoda pesin at-all.
28 So wetin make yu dey akuiz mi dey sey,
‘Na yu kause di wahala wey yu dey face?’
29 But fear di swod naw;
dat swod wey dey bring God ponishment.
So make yu know sey e get pesin wey go judge my kase.”