20
Zofar Still Tok
Zofar still sey:
“Job! Yu dey make mi vex.
Naw, I nor fit wait before I ansa.
All di tins wey yu dey tok since, na curse!
But I know wetin to tell yu.
Yu know sey wen God first kreate human being,
wikedness nor dey
and di joy wen pesin wey nor dey fear God get,
nor dey last.
Dem fit big well-well,
dey great and dia head dey tosh heaven,
but God go blow all of dem trowey like dust.
Pipol wey know dem before go sopraiz
kon ask, ‘Where dem go?’
Dem go vanish like dream and vishon for nite
and pipol nor go si dem again.
Pipol wey si dem before,
nor go si dem again.
Dia family nor go si dem again
10 and dia shidren go beg poor pipol;
dem go pay back all wetin dia papa tif
from poor pipol hand.
11 Dia smooth and betta body,
go soon turn to dust.
12 Bikos bad tins sweet,
dem kon keep some for dia mout
13 and bikos dem won enjoy di sweetness,
dem nor gri komot am from dia mout.
14 But di food go betta like poizin for dia belle.
E go bi like snake poizin inside dia body.
15 Wiked pipol go vomit di money wey dem tif.
God go take am back with di ones wey dey dia belle.
16 Wetin wiked pipol swallow bi like poizin;
e dey kill dem like who wiked snake bite.
17 Dem nor go live to si di river wey get olive
or di one wey milk and honey full.
18 Dem must die leave evritin wey dem work for;
dem nor go get shance to chop from dia money,
19 bikos dem don beat and kollect from pipol wey nor get.
Dem still seize dia house,
20 bikos nor-tin dey rish dem,
but wetin dem get nor go fit save dem.
21 Nor-tin dey remain for plate wey dem take chop;
dat na why dia propaty nor dey last.
22 Wen dia propaty don dey plenty,
trobol go kom skata and distroy am.
23 Make God feed dem beleful with trobol.
Make God pour in vexnashon for dia head
like evening rain dey fall.
24 Wen dem won run, bikos of iron swod,
di bronze bow go shot dem fall.
25 As dem pul di arrow komot dia body,
blood go rush kom out
and fear go kill dem trowey.
26 Evritin wey dem don save, go skata.
Fire wey pesin nor lite,
na-im go kom burn dem die with dia family.
27 Heaven nor go kover dia sins
and di eart go tok against dem.
28 Evritin wey dem get,
God go distroy am with wota wen E dey vex.
29 Dis na wetin go happen to wiked pipol!
Dis na wetin God go do dem.”