21
Job Ansa Zofar
Job ansa:
“Make yu listin to wetin I dey tok.
Dis na all di konfort wey I ask from yu.
Give mi shance make I tok and if I tok finish,
yu fit laf mi, if yu like.
I dey komplain give human being?
If I nor dey komplain give human being,
wetin go make mi kwayet?
Di way yu dey si mi naw dey sopraiz yu!
Make yu shok put yor hand for mout.
Wen I tink about wetin dey happen to mi,
my body go dey shake, bikos of fear.
Wiked Pipol Dey Prosper
“Why God dey let wiked pipol live?
Why E dey make dem old kon prosper?
Dem get shidren and grand-grand shidren
and dem dey si as dia shidren dey grow.
God nor dey send trobol go skata dia house;
dem nor dey live with fear.
10 All dia kattle dey get belle
and born without trobol or wahala.
11 Dia shidren dey run and play like animal pikin
wey nor get problem.
12 Dem dey dance, dey play sheke-sheke,
harp and dey enjoy dia trumpet sound.
13 Dem dey live dia life for peace
and dey die without trobol.
14 Dem dey tell God sey
‘Leave us! Wi nor won serve or follow Yu.’
15 Dem sey ‘Who bi dis God sef?
Why wi go serve am?
Any gain dey to pray to am?’
16 Dem tink sey na dia pawa dem take get evritin wey dem get,
but I nor agri with wetin dem dey tink.
How Many Time Wiked Pipol Dey Sofa
17 “Dem don ever kwensh di lite wey wiked pipol get?
Wiked pipol don ever face trobol?
God don ever vex ponish wiked pipol?
18 How many times dem bi like leaf wey breeze blow trowey
or dust wey breeze karry go?
19 Yu dey sey, ‘God go ponish pikin for di sin wey en papa kommit!’
No! But make God ponish di pesin wey sin,
so dat e go know wetin e do!
20 Make who sin karry di trobol by ensef;
make dem feel God vexnashon.
21 Bikos wen pesin die,
e nor kare about wetin happen to en family.
22 Anybody fit tish God,
abi who dey judge doz wey dey heaven?
Na Deat Dey Setol Evritin
23 “Some pipol nor sick at-all until di day wen dem die;
dem die with happiness and dem dey for peace.
24 Dia body dey shine well-well
and dia bones dey strong.
25 Odas nor get happiness at-all;
dem live and die with bitterness for dia mind.
26 But evribody must die.
Dem dey beri who don die and worm dey kover di body.
Betta Words! Lie-lie Ansa
27 “Yes! I know wetin yu dey tink.
Yu dey tink how yu go take wound mi
28 Yu go soon tell mi about rish
and wiked pipol wey dia house don vanish bikos of sin.
29 Abi yu neva tok to pipol wey travel before?
Yu nor know di kind ripot wey dem dey bring kom back?
30 Di day wey God go vex ponish pipol,
na di wiked ones E go sorry for.
31 E nor get who fit blame wiked pipol
for all wetin dem don do.
32 Dem go guide di grave wey dem beri
dem put afta dem don die.
33 Pipol go many for dia burial
and di san go kold for dia body.
34 So how yor bad words won take konfort mi
wey e bi sey evry ansa wey yu dey give mi, na lie!”