23
Job Ansa Again
Job kon ansa:
“Today, my komplain still dey make my heart betta;
I nor fit hold my bitterness.
If to sey I know where I go for si God
and how to go where E dey,
I for komplain gi-am
kon tell am all di trobol wey I dey face.
I won know wetin E go tok
and how E go ansa mi.
God go fight mi with all en pawa?
No! I nor tink so.
E go listin and ansa mi wen I tok.
Since pesin wey dey rite with God fit go follow am tok,
den E go diliver mi from pipol wey dey judge mi, forever.
I don find am go east, but I nor si am.
I nor si am for west wen I find am go der too.
Wen God dey work for nort and sout,
I nor still si am.
10 Yet, God know evry step wey I dey take.
If E sey make E test mi,
I go klean kom out like gold.
11 Bikos I just dey waka follow God for back;
for di road wey E choose by ensef
and I nor dey waka on my own.
12 I dey always do wetin E tok;
dey follow en words; nor bi my own.
13 E neva shange and nobody fit oppoz
or stop am from wetin E won do.
14 E go do wetin E don plan for mi.
Na-im dey kontrol my destini.
15 Na dis make mi dey fear and wen ever I si am,
my hold body go dey shake.
16 True-true, na God make mi dey fear.
E don distroy di mind wey I get.
17 Na God, nor bi di darkness make mi kwayet,
even doh di darkness don kover my face.