24
God Difren From Man
“Why God nor set di time wen E go take judge pipol;
di day wey E go judge di pipol wey dey woship am?
Stone wey dem take mark land,
pipol dey move am komot from where dem put am,
so dat dem go get many land;
dem still dey tif animals join dia own.
Shidren wey nor get papa and mama again,
dem dey take dia donkey
and bikos of di money wey wimen wey
nor get husband dey hold,
pipol dey seize dia animals.
Dem nor let poor pipol get wetin dem suppose get
and doz wey nor get at-all,
dey run go hide.
Just like wiked donkey for desert, na so poor pipol dey find food waka.
Dem even dey find food rish desert
so dat dia shidren go chop.
Dem just dey work for land wey nor bi dia own
and dem dey chop from wiked pipol land.
For nite, dem dey sleep without kover klot;
nor-tin dey to keep dem from kold.
Rain wey dey fall on-top di mountin dey beat dem
and dem dey go hide under rock, bikos dem nor get house.
Wiked pipol dey use small pikin wey nor get papa take do slave
kon seize poor pipol shidren,
bikos of di money wey dem dey hold.
10 But poor pipol dey naked go out;
na with honga dem take dey work.
11 Dem go press oil kom out from olive fruit
and wine from grape fruit,
but demsef nor go even si wota drink.
12 For inside town, doz wey wound
and di ones wey dey die, dey kry,
but God nor dey ansa dem.
13 E get pipol wey rijet di lite;
dem nor undastand di lite
or follow where e dey lead dem go.
14 For day break, wiked pipol go get up go kill poor pipol
and for nite,
dem go-go tif dia propaty.
15 Di ones wey don marry wey dey sleep with oda pipol,
go kover dia face make nobody si dem.
16 For nite, tif go break enter pipol house,
but for day time, di tif go-go hide from lite.
17 Dem dey fear morning lite,
but dem nor get anytin to fear for nite.
18 But na wota go karry wiked pipol go;
God go curse dia land
and nobody go work for dia farm again.
19 As snow dey dry for heat and melt for sun,
na so sinnas go vanish from dis land.
20 Even dia mama nor go remember dem again.
Na worm go chop dem and dem go bi like tree wey dem kut trowey.
21 Dem dey ponish wimen wey dia husband don die
and doz wey nor get pikin.
22 But God go distroy wiked pipol with en pawa;
wen God take akshon, wiked pipol nor get hope again.
23 God fit let dem stay for peace,
but en eye nor go komot for dia body at-all.
24 Wiked pipol fit dey great naw,
but e nor go tey before dem go die go like grass
and korn wey dem kut trowey.
25 If nor bi so e bi, who go fit sey I dey lie
or sey wetin I tok, nor bi true?”