32
Elihu Tok For Di First Time
So Job three friends nor gri ansa Job again, bikos dem know sey e dey tok trut. Den Elihu wey bi Barakel pikin from Ram family for Buz kon dey vex. E dey vex, bikos Job sey e nor do God anytin. E still vex for Job friends, bikos dem nor know how to ansa Job and evritin kon bi like sey, na God dey wrong. Bikos na Elihu small pass for der, e wait until evribody tok finish. Wen e si sey di three men nor fit ansa Job again, e kon dey vex.
Elihu Wisdom
Elihu wey en papa na Barakel wey kom from Buz kon sey:
“I know sey I small and yu don old
and na dis make mi dey fear to tell yu wetin I dey tink.
I tell mysef sey make una tok,
bikos una wey don old fit get wisdom wey una go share.
But I don si am sey na God Almighty spirit dey enter
and give human being wisdom.
Nor bi old age go make pesin wise
or tish pipol how to undastand wetin dey rite.
10 Naw, I won tok and una go listin to mi.
Make I tell una wetin I know.
11 I kwayet dey listin to wetin una dey tok since;
I dey listin to una wise word
and as una dey tink wetin to tok.
12 I hear una well-well,
but una nor fit show sey Job dey wrong;
nobody among una fit ansa en kweshon.
13 So why una dey tell pipol sey una get wisdom?
Naw, na only God go fit ansa am, bikos una don fail.
14 Job dey tok to una;
nor bi mi e dey tok to, but if na mi e tok to,
I nor go ansa am di way wey una take ansa am.
Job Friends Nor Fit Ansa
15 “Job, yor words too strong for all of dem;
dem nor get ansa for yu.
16 Make I dey wait wen dem nor get anytin to tok?
Dem just stand for der,
bikos dem nor get anytin to tok again.
17 But I go give yu my own ansa
and I go tell yu wetin I dey tink.
18 I nor fit wait to tok
or hold my words again.
19 If una nor let mi tok,
my belle go burst like wine wey dey new wine bag.
20 I must tok make I dey free!
I nor fit bear-am again!
21 I nor go support one pesin for dis matter
and I nor go praiz anybody sef!
22 I nor sabi praiz pesin anyhow,
bikos God go ponish mi,
if I do like dat.