33
Elihu Tok To Job
“Job, make yu listin
and hear evritin wey I won tok!
Si naw, I don open my mout
and my tongue won start to tok.
All my words na true
and na true I go tok.
Na God Spirit make mi
and na en breath give mi life.
Make yu ansa mi if yu fit.
Make yu dey ready and prepare yor kweshons.
Na di same tin mi and yu bi for God eye,
na san dem take make mi and yu.
So yu nor get rizin to fear mi
and I nor go wahala yu too mush.
Elihu And Job
“Naw, dis na wetin I hear
wen yu dey tok:
‘I nor dey guilty;
I neva do any bad tin or kommit sin.
10 But God dey find rizin make E for dey ponish mi
like sey I bi en enemy.
11 E tie my leg with shain;
E dey si evriwhere wey I waka go.’
12 But I won tell yu sey yu dey wrong,
bikos God big pass evribody.
13 Why yu dey akuiz God sey E
nor dey ever ansa yor komplain?
Elihu Nor Agri With Wetin Job Tok
14 “Even as God dey tok evritime,
nobody won wait listin to wetin E dey tok.
15 For nite wey pipol dey sleep,
God dey tok to dem for vishon or thru dreams.
16 Wen E make dem listin to wetin E dey tok,
dem go dey fear for di warnin wey E dey give dem.
17 God dey tok so dat dem go stop to sin kon honbol demsef,
make E for fit save dem.
18 E nor go let dem distroy demsef;
E go save dem from deat.
19 God dey send sickness to take korrect some pipol
and dem go take korreshon
wen dia body dey feel di pain.
20 Pipol wey dey sick nor fit even chop di food
wey sweet well-well.
21 Dia body dey die go
and yu nor go fit si dia bones again.
22 Dem go soon go join dead body.
Deat angel dey wait for dem.
23 May bi one angel go help am;
one out of di tazon angels wey God get
wey go tell am wetin dey rite.
24 Bikos God don forgi-am, di angel go sey,
‘Release am! E nor go fit go join dead body.
Si wetin dem take replace en sin,
so e don dey free.’
25 En body go kom yong and strong again
like small pikin own.
26 Den wen e pray, God go ansa am.
E go woship God with happiness.
God go make am dey raitious for en eye again.
27 Di pesin go sing give odas sey,
‘I sin kon do wetin dey bad,
but God nor ponish mi as e suppose to bi.’
28 E don save mi from deat
and I still dey alive.
Elihu Kom Beg Job
29 “True-true, God dey always do like dis,
many-many times with pipol.
30 E dey save pesin life from deat
and make am enjoy life again.
31 So Job, make yu listin to wetin I dey tok.
Naw, kwayet make yu let mi tok.
32 But if yu get wetin yu won tok,
tok and I go tell yu if yu dey rite.
33 But if yu nor get,
make yu kwayet listin to mi
and I go tish yu wisdom.”