40
Job Ansa God
Den God tell Job:
“Yu dey argue with God Almighty;
yu don taya to tok or yu still get word to tell mi?”
Den Job ansa God:
“True-true, I dey tok like fool since,
wetin I go fit ansa? I nor go try tok anytin again.
I don tok pass wetin I suppose tok.
I nor get anytin to tok again?”
God Tok Again
Den from inside di storm, God kon ansa Job:
Make yu stand strait
kon ansa my kweshons.
Yu dey try to sey I dey wiked,
bikos yu dey sey I dey wrong and yu dey rite?
Yu strong rish mi?
Abi yor vois loud rish my own?
10 If na so, stand up make yu ansa mi;
dress like king make yu hail yorsef.
11 Look pipol wey tink sey dem dey important,
den go honbol dem, bikos yu dey vex.
12 Yes! Look dem, make yu bring dem
kom down kon skata where wiked pipol stand put.
13 Beri all of dem for groun
kon tie dem for where dead body dey.
14 Den na mi go first praiz yu
kon gri sey yu don win di fight by yorsef.
God Diskribe Behemot
15 Si Behemot; I make am di way I make yu,
e dey chop grass like melu,
16 but si as en strent bi like lion own
and e pawa dey en body.
17 En tail stand like tall tree
and di pawa wey dey e leg, strong well-well.
18 En bones strong like bronze
and en leg bi like iron bar.
19 E dey among di tins wey God kreate wey dey sopraiz pipol!
Na only God wey kreate am go fit distroy am.
20 Grass wey dem go chop,
dey grow for di hill wey bush animals dey for play.
21 E dey sleep for under tree wey valley wota dey pass
and e go hide among di reeds for di bush.
22 Inside bush dey gi-am betta place to rest.
Di tall tree dey gi-am shade.
23 E nor dey fear wota wey dey rush pass like river;
en body go kold wen Jordan River flow pass en face.
24 Who fit blind en eyes kom katch am?
Na who fit use trap katch am thru en nose and mout?