41
God Diskribe Leviatan
“Yu fit use fish hook take katch Leviatan
or use rope take tie en tongue?
Yu fit put rope pass en nose
or hook en jaw?
E go beg yu make yu let am go?
Or make e beg yu make yu sorry for am?
E go gri make agriment with yu
kon promise sey e go serve yu forever?
Yu go fit tie am like bird wey dem dey train for house;
or like sometin wey go sweet yor wimen savant to play with?
Pipol wey dey katch fish go gri follow am enter agriment?
Pipol wey dey sell pesin go gri sell am?
Yu go fit tosh en skin with spear wey dem take dey katch fish
or katch en head with hook?
Make yu try go tosh am, den yu nor go ever try am again;
bikos yu nor go ever forget di fight!
Anybody wey si Leviatan go fear
fall for groun.
10 Wen dem don make am vex, e go shaut
and nobody go try go stand for en front.
11 Who don give mi anytin kon sey make I pay back?
Evritin wey dey under heaven na my own?
12 Make I tell yu about Leviatan leg
kon tell yu how e dey big and strong well-well.
13 Nobody fit tear en klot wey dey outside
or shuk di armour wey e wear.
14 Who fit open en mout or bring en tit wey dey make pesin fear,
kom out?
15 Na many shield dem take make en back
kon tie dem togeda and dem strong like stone.
16 Dem join dem strong well-well
and space nor dey wey breeze fit pass enter en body.
17 En body strong well-well and nor-tin fit tear am En body join togeda and nor-tin fit separate dem.
18 Wen e sneeze, lite go flash kom out
and na so en eye dey shine like sun for aftanoon.
19 Fire and tonda lite dey
kom out from en mout.
20 Like grass wey dey burn under pot, na so too smoke dey
kom out from en nose.
21 Fire dey kom out from en mout and even wen e breath,
e dey bring fire.
22 En neck get strong pawa wey fit
make evribody wey near am, fear.
23 E nor get any weak part for en skin;
e dey strong well-well
and e bi like iron wey dem nor fit bend.
24 En heart bi like stone wey nor dey fear anytin;
e dey strong well-well like grindin stone.
25 Wen e stand, even pipol wey strong well-well,
dey fear and di fear dey make dem shake anyhow.
26 No swod fit wound am;
no spear or arrow fit enter en body.
27 Iron just bi like straw for en eye
and bronze dey soft like wood wey don rotin.
28 E nor get di arrow wey won make am run,
even wen dem stone am with rock,
e bi like straw for en body.
29 Spear bi like straw to am
and e dey laf wen men dey trow arrow kom meet am.
30 Di skale wey dey en belle bi like pot wey don break;
as e dey waka, e dey leave mark for di mud like
sey e won separate di groun.
31 E dey shake di sea like wota wey dey boil
kon make am dey dance like oil for pot.
32 E dey leave shine-shine part for en back
kon make di sea get white foam.
33 E nor get anytin for eart wey yu fit take kompare am
and I kreate am without fear.
34 Even di animal wey dey karry body up,
e dey look dem like nor-tin;
bikos naim bi king among all animals.”