8
Bildad Tok
Bildad wey kom from Shuah kon sey:
“Job, wen yu go stop to dey tok like dis,
wen e bi sey di word wey dey yor mout bi like strong wind?
Abi God nor dey like justice?
Abi God nor dey do wetin dey rite?
Yor shidren go don sin against God,
naim make am pay dem for dia sin.
But if yu look up to God
kon beg di Oga wey dey mighty;
if yu klean yorsef kon koll am yor Savior,
E go help yu kon give yu back evritin.
Yor biginnin fit dey small for eye naw,
but yor ending go betta well-well.
Make yu ask generashons wey don pass;
tink and follow di trut wey dem sabi;
bikos dis life wey wi dey so, short well-well.
Wi nor know anytin at-all and awa days
for dis eart bi like shadow wey go kwik vanish.
10 But make yu let doz wey get sense before dem die, tish yu;
make yu listin to wetin dem dey tok:
11 Papyrus plants fit grow for where river nor dey?
Abi reed fit grow without wota?
12 If wota dry, na dem go first die
wen e neva rish to kut or use dem.
13 Pipol wey nor dey fear God bi like di reed;
dia hope don go as dem just forget God.
14 Dem bilive bad-bad tins
and dia sekurity bi like spider house.
15 If dem rest for spider house, e go fit hold dem?
If dem hold di spider rope, e go fit make dem stand?
16 Wiked pipol plenty like betta grass for sun wey dem dey wota,
wey skata around di gardin.
17 Dem wrap dia rut for plenty stone
kon dey look for where dem go hide put for di rock.
18 But if dem rut dem komot for dia place,
dat place go rijet dem kon sey,
‘I neva si una before!’
19 Yes, dat na all di joy wey wiked pipol get
and from inside di eart,
odas go kom take dia place.
20 But God nor go ever help wiked pipol
kon let pesin wey dey fear am, sofa.
21 E go pak laf full yor mout
and yor lip go dey happy.
22 But E go disgrace pipol wey hate yu
and wiked pipol house go vanish.”