9
Job Ansa Bildad
Den Job ansa:
“Yes, all dis tins wey yu dey tok so,
I don hear dem before.
But how pesin go fit take win kase with God?
Wetin go make pesin argue with God?
E go fit ask God kweshon wey E
nor go fit ansa?
God too get sense and en pawa dey mighty;
nobody fit stand against am.
E dey move mountins anytime E wont
kon skata dem with vexnashon.
God wey shake di eart komot from where e dey!
E shake di pilas wey support di eart.
Di One wey kommand di sun and di sun nor raiz;
di stars sef nor shine for nite.
Na only en make di heavens
kon waka on-top wave for sea.
Na God make di Bear, Orion, di Pleiades
and di sky for sout.
10 Wi nor go fit undastand di great tins wey E dey do
and all di wonderful tins wey nobody fit kount.
11 Even if God pass naw, I nor go fit si am.
If e waka pass, I nor go even smell am sef.
12 Nobody fit stop am. E dey take wetin E won take.
Nobody fit even ask am, ‘Wetin Yu dey do?’
13 If God dey vex, nobody go fit stop am.
Even juju for wota dey under en leg.
To Face God For Kourt
14 “So, na how I won take
find word take ansa God?
15 Even if I nor do any bad tin,
di only tin wey I fit still do na
to beg for mesi from God wey bi my judge.
16 Even if I koll am and E ansa mi,
I nor go bilive sey E dey listin to wetin I dey tok.
17 E send breeze kom attack and wound mi,
even doh I nor do any bad tin.
18 E nor let mi breath well;
E don kover my life with bitterness.
19 Even if na to use pawa, E strong pass mi.
Abi I go fit take am go kourt?
Who go fit bring am kom di kourt?
20 I know sey I nor do any bad tin, but my mout fit kondemn mi.
Even doh I dey innocent,
my mout go still fit put mi for wahala.
21 I know kare again, life don taya mi,
bikos I know sey I nor do any bad tin.
God Justice Na For Evribody
22 “All of dem na di same!
Na dis make mi dey sey,
E dey distroy both who nor do anytin
and di ones wey dey do bad tins.
23 Wen pesin wey nor do bad tin die like dat,
God go just dey laf.
24 God don give dis eart to wiked pipol
kon kover all di judge dem face.
If nor bi en do am, den na who fit?
Job Still Dey Komplain
25 “No day good for my life since dem born mi
and dem nor dey last.
26 My life just dey rush pass like speed boat;
like eagle wey won katch rabbit.
27 If I tok sey I go forget my komplain
or I go try to dey happy,
28 my trobols go still kom back again;
den I go know sey Yu dey hold mi
bikos of di bad tins wey I do.
29 If I dey guilty,
wetin go make mi komplain?
30 Even if I use soap wosh my body
and make my hand klean well-well,
31 Yu go still trow mi put for dirty pit
and even di klot wey I wear, go rijet mi.
32 If to sey God na pesin, I for ansa am.
Wi for go setol awa matter for kourt.
33 Nobody fit setol us!
Nobody go fit setol mi and my God.
34 Who go fit stop god make E nor ponish mi again,
so dat e nor go make mi fear again.
35 Den I nor go fear as I dey tok,
but naw, nor bi so e bi with mi.