14
Samson Marriage
One day, Samson go Timnah, where e for si one Filistia girl and e like am well-well. Wen e go house back, e kon tell en papa and mama, “I si one Filistia girl for Timnah wey I like, make una bring am for mi, bikos I won marry am.”
But en papa and mama nor happy. So dem ask am, “Yu nor si any woman wey yu like for awa family or di whole Israel wey yu fit marry? Why e bi sey na Filistia woman yu won marry?”
But Samson tell en papa, “Make una go marry am for mi, bikos e look like betta pesin to mi.” En papa and mama nor know sey, na God dey lead Samson make e do am, bikos God dey find way wey E won take fight Filistia pipol, bikos na dem dey rule Israel pipol. Wen Samson, en papa and mama dey go Timnah, as dem pass di vineyard, one yong lion just kom attack Samson. At wons, God Spirit make Samson strong and e tear di lion with en ordinary hand like sey na small goat. But e nor tell en papa and mama wetin happen. Wen Samson rish Timnah, e go tok to di girl, bikos e like am.
Leta, as Samson dey go marry di girl, e kon branch go look di lion wey e kill and e sopraiz to si bee and some honey inside di lion dead body. E take some of di honey for en hand kon dey lick am as e dey waka go. Den e take some go give en papa and mama. Dem lick am, but Samson nor tell dem sey na from lion dead body e for take am.
10 Wen Samson papa dey make di final arrangement for di marriage, Samson kon do party for der, bikos dis na wetin di yong men dem dey do. 11 Wen di girl papa si am, dem selet thirty men for di town make dem stay with am.
12 So Samson tell dem, “Make I tell una one problem, if una fit solve am for di next seven days, I go give una thirty fine linen robe and thirty klot wey dem take dey go party. 13 But if una nor fit solve am, una go give mi thirty fine linen robe and thirty klot wey dem take dey go party.”
So dem kon gri.
14 Samson tell dem,
“Di pesin wey chop,
na-im dey bring wetin dem go chop
and na from wetin strong,
sweet tin for dey kom out.”
Afta three days, dem neva still fit solve am.
15 For di fourt day, dem kon tell Samson wife to bi, “Deceive yor husband to bi, so dat e go tell yu di ansa of wetin e tell us; if not, wi go burn yu and yor papa family togeda, bikos e bi like sey yu invite us kom here, so dat wi go dey poor.”
16 So Samson wife to bi kry go meet am sey, “Yu nor love mi; yu hate mi! Yu tell my pipol sometin and yu neva tell mi di ansa.”
But Samson tell am, “I neva even tell my papa and mama di ansa, so wetin go make mi tell yu?” 17 Thru-out di seven days wey dem do di party, di woman dey always kry for Samson. But for di sevent day, Samson kon tell am di ansa, bikos e dey always disturb am. Den di woman go tell di pipol.
18 So for di sevent day, as evening dey rish, di men kon tell Samson di ansa sey,
“Na wetin go fit dey sweet pass honey
or wish tin or animal strong pass lion?”
But Samson ansa dem,
“If to sey, una nor work with my melu,
una nor for know di ansa.”
19 At wons God Spirit enter Samson kon make am strong, so e go Ashkelon kon kill thirty men, den e take dia klot, kon give dem to di men wey solve di problem. Leta, e go back to en papa and mama house kon dey vex bikos of wetin happen. 20 So dem kon give Samson wife to bi to Samson best man for di marriage.