15
Samson And Filistia Pipol
For di time wen dem dey harvest wheat, Samson kon take one small goat go visit en wife to bi. Wen e rish der, e tell en wife papa, “I won go my wife room.” But di papa nor gri.
Den di man tell Samson, “I bin tink sey yu hate my dota, so I kon gi-am to yor best man as en wife. But si, en yonga sista fine pass am well-well. Yu fit marry dat one.”
But Samson sey, “Dis time, dem nor go blame mi for wetin I go do Filistia pipol.” So e go outside kon go katch 300 fox, e tie dia tail two-two togeda with rope. Den e lite fire put for di rope wey dey dia tail kon porshu dem enter Filistia pipol farm and dem burn all wetin dem plant for di farm rish groun. E even still distroy dia vineyards and olive trees.
So Filistia pipol ask, “Who do dis tin?” Dem kon sey, “Na Samson, bikos en fada-in-law to bi wey kom from Timnah, give di woman to en best man.”
So Filistia pipol vex kon go burn di girl, en papa and dia house rish groun.
Samson tell dem, “Na so una dey bihave! I swear, I nor go stop until I pay una back!” So e attack dem with vexnashon kon kill many of dem. Afta, e kon go stay for inside rock for Etam kave.
Filistia pipol kom kamp for Judah, near Lehi town. 10 Den, Judah men ask Filistia pipol, “Wetin make una won fight us?”
Den Filistia pipol ansa, “Wi wont Samson. Wi kom pay am back for wetin e do us.”
11 So 3,000 men from Judah go di kave for di rock for Etam, go meet Samson kon tell am, “Yu nor know sey na Filistia pipol dey rule us? Wetin yu do to us so?”
Samson ansa dem, “I pay dem back for wetin dem do mi.”
12 But dem tell am, “Wi kom here kon tie yu, so dat wi go karry yu give dem.”
So Samson sey, “Okay! But make una promise mi sey, una nor go kill mi by unasef.”
13 Dem gri kon sey, “Wi nor go kill yu; na only tie wi won tie yu karry give dem.” So dem tie am with two new rope kon karry am komot from di rock. 14 As Samson rish Lehi, Filistia sojas kom dey happy dey shaut. At wons, God pawa enter Samson and e kut di rope wey dem take tie am like sey na tread wey dey burn. 15 One donkey wey dem just kill, Samson si en bone for groun. So e pick di bone kon use am kill 1,000 Filistia sojas.
16 Den Samson sey,
“Na with donkey bone I take
kill 1,000 men
kon gada dia bones togeda.”
17 Afta e don boast finish, e trowey di bone kon koll di place, “Bone Hill.”
18 Leta, Samson kon dey hongry for wota, den e kry give God sey, “Yu give mi dis viktory finish, make dis wiked Filistia pipol kon katch and kill mi, bikos wota dey hongry mi?” 19 So God allow wota kom out from one place for di groun for Lehi, den Samson drink until e beleful. So e kon koll di place “En-Hakkore” and e still dey for Lehi till today.
20 Samson lead Israel pipol for twenty years, even doh Filistia pipol still dey rule di land.