2
Jonah Pray
As Jonah dey inside di fish belle, e kon pray to God. E sey,
“I kry give Yu wen I dey wahala and Yu ansa mi.
Naw, I dey kry to Yu from where dead body dey,
so make Yu go kom help mi and hear my prayers.
Na Yu God trow mi inside dis deep sea.
Yu trow mi inside di river
and di wota and waves kon kover mi.
Den I sey, ‘Oga God,
Yu don drive mi
komot from yor present kpata-kpata
and I nor go ever si yor holy temple again!’
Di wota kover and almost kill mi.
Naw, I don sink enter di sea.
Even di leaf dem wey dey di sea,
don tie my head.
I sink go under di mountins
kon enter inside one place
where I go bi prisona forever.
But Yu, my God don take mi
komot from di pit.
Wen I tink sey my life don dey finish,
I kon pray give Yu and Yu hear mi
from yor holy temple.
Doz wey dey woship juju,
don abandon di good tins wey God suppose do for dem.
But as for mi, I go sing praiz Yu;
I go offa sakrifice give Yu
kon do wetin I promise,
bikos na only Yu fit save mi!”
10 Den God kon kommand di fish make e go vomit Jonah put for dry land.