3
Jonah Go Nineveh
God kon tell Jonah for di sekond time, “Make yu go Nineveh, dat big town kon tell di pipol my message.” So Jonah obey God kon go Nineveh. (Nineveh na one big town and e go take three days to waka round am!) For di day wen Jonah enter di town, e kon tell di pipol, “Afta forty days, God go distroy Nineveh finish!”
Nineveh pipol bilive God message, so dem kon sey make evribody fast and wear sak and evribody, both small and old, do wetin dia leaders tell dem. Wen dia king hear di news, e get up from en throne, remove en fine klot, wear sak kon sidan for ashes. E kon kommand, “For inside dis kingdom, Nineveh, mi and all my ofisas don gri sey: ‘Make nobody or animal, chop or drink anytin. Make evribody and dia animals wear sak kon pray well-well to God, den turn from dia sin go meet am.’ May bi God go shange en mind kon stop to vex for us, den wi nor go die again!” 10 So wen God si wetin dem dey do: sey dem don really turn kom meet am, E kon shange en mind and E nor ponish dem again, just as E bin won do.