12
Mary Pour Oil For Jesus Leg
Six days before Passova Feast rish, Jesus go Betany, where Lazarus, di pesin wey e wake-up from deat, dey stay. So dem kon do party for Jesus dat evening. Marta kon dey serve dem food and Lazarus dey among di pipol wey sidan for tabol with Jesus. Mary take perfume wey dear well-well, wey plenty rish kwota gallon kon pour am for Jesus two leg. Den e use en hair take klean dem. (Di perfume send kon full evriwhere for inside di house).
But Judas Iskariot, one among Jesus disciple (di pesin wey go sell am give en enemies) kon sey, “Why wi nor sell dis perfume for three hundred koins (money wey pass wetin workers go get for one year) kon give di money to poor pipol?” (Judas tok like dis, nor bi sey e kare for poor pipol, but bikos na tif e bi. As e bi sey naim dey keep di money, e dey tif from am.)
Den Jesus ansa, “Make yu nor trobol di woman, e do dis tin dey wait di day wen dem go beri mi. Poor pipol go always dey with una, but I nor go dey with una all di time.”
For dis time, plenty pipol wey dey Judea hear sey Jesus dey for dia town, so dem kon gada, nor bi bikos of Jesus alone, but dem won si Lazarus too, di pesin wey die before, wey Jesus wake-up. 10 Di priest oga dem kon plan to kill Lazarus too, 11 bikos naim make plenty Jew pipol for Jerusalem, bilive Jesus.
Jesus Enter Jerusalem
12 Wen day break, plenty pipol wey kom di Feast kon hear sey Jesus dey kom Jerusalem. 13 Di pipol take palm tree leaf go wait am for road. Dem kon bigin shaut,
“Hosanna, make God bless di pesin wey E send kom meet us.
Make God bless Israel king!”
14 Jesus si one small donkey and e kon sidan put, just as God word sey,
15 “Pipol wey dey Zion,
make una nor fear;
make una si una king sidan on-top donkey dey kom!”
16 (En disciples nor undastand dis tins wey dey happen, until wen Jesus don wake-up from grave, naim dem kon remember wetin God word sey go happen.)
17 So di pipol wey dey with am wen e wake Lazarus from grave kon tell odas about am. 18 And dem gada go meet Jesus, bikos dem hear sey na-im wake Lazarus from grave. 19 Den di Farisee pipol kon tell each oda, “Una dey si sey wetin wi dey do so nor get head! Si o-o, evribody don bigin follow am.”
Some Greek Pipol Kon Meet Jesus
20 Some Greek pipol go woship God for di feast for Jerusalem. 21 Dem meet Filip wey kom from Betsaida for Galilee kon tell am, “Oga God, wi go like to si Jesus.” 22 Filip tell Andru, den dem kon go tell Jesus.
23 Jesus tell dem, “Di time don kom wen God go honor en own pikin. 24 I tell una true word, if one korn seed fall for groun and e nor die, e nor go grow, but if e die, e go grow kon bear plenty seed. 25 Anybody wey love en life for dis world, go luz am, but di pesin wey nor love en life for dis world, go get life wey nor dey end. 26 Anybody wey ready to serve mi, go must follow mi and where I dey, na der my savant go dey too. Anybody wey serve mi, my Papa go honor am.
27 “My heart heavy well-well. Wetin I go tok? ‘Papa, make yu save mi from dis tin wey won happen’? No! Na dis tin make mi kom dis world. 28 Papa, make yu honor yor name.”
Den one vois tok from heaven sey, “I don honor am before and I go honor am again.” 29 Wen di pipol wey dey di place hear di vois, some kon sey, “Di vois sound like tonda”, but odas sey, “Na angel dey tok to am.”
30 Jesus kon sey, “Dis vois nor tok bikos of mi, but na bikos of una. 31 Di time to judge di pipol for dis world don rish and God go drive Satan, wey dey kontrol dis world komot. 32 But as for mi, if una karry mi go up for cross, I go draw evribody kom meet mi.” 33 (E tok like dis, make pipol for know di way e go take die).
34 Den di pipol ask, “Wi know sey God law sey, ‘Christ go live forever.’ Why yu kon dey tok sey dem go karry Man Pikin put for cross? Na who bi dis Man Pikin sef?”
35 Jesus ansa dem, “My lite nor go dey with una tey. Naw wen di lite dey, make una take am waka, so dat darkness nor go kover una. Bikos di pesin wey dey waka for darkness, nor dey si where e dey go. 36 As una get di lite naw, make una bilive am, so dat una go bi lite shidren.” Wen Jesus don tok dis tin finish, e kon komot der go hide.
Why Pipol Nor Agri Bilive Jesus
37 Aldo Jesus don do many mirakle for dia front, dem nor still bilive am. 38 Dis make wetin Profet Isaya tok happen, wen e sey,
“Oga God, wish pipol don bilive wetin wi tok
and who God don show en pawa?”
39 As di pipol nor fit bilive, naim make Profet Isaya tok anoda word sey,
40 “God don blind dia eye
and make dia heart strong like stone,
so dat dem nor go si with dia eye and undastand with dia heart,
so dem nor go fit kom meet mi,
make I for heal dem.”
41 Profet Isaya tok dis tins, bikos e si how God honor and tok about Christ.
42 Many pipol and many Jew oga kon bilive Jesus, but bikos of di Farisee pipol, doz wey bilive nor fit tok for publik about Jesus Christ, so dat dem nor go drive dem komot for di sinagog. 43 Bikos Jew pipol like make pipol dey praiz dem pass wetin God tink about dem.
Di Last Tin Wey Jesus Tok For Publik
44 Jesus kon shaut sey, “Di pesin wey bilive mi, nor bi mi e bilive, but na my Papa wey send mi. 45 And di pesin wey si mi, don si God wey send mi. 46 I kom as lite for dis world, so dat anybody wey go bilive mi nor go waka inside darkness.
47 “Anybody wey hear wetin I tok and nor obey am, nor bi mi go judge am, bikos I nor kom judge di world, but I kom save pipol for di world. 48 Anybody wey rijet mi and nor do wetin I tok, God go use dis my word judge am for di last day. 49 Bikos nor bi my pawa I take dey tok, but na my Papa wey send mi dey tell mi wetin I dey tok. 50 I know sey anytin wey God kommand, dey give life wey nor dey end, so I dey tok wetin E send mi.”