13
Jesus Wosh En Disciples Leg
Before dem do di Passova Feast, Jesus know sey en time don rish wen e go komot for dis world go meet en Papa. Bikos e love di pipol wey dey di world, e kon show dem how en love for dem strong rish.
Before dem start to chop evening food, devil don already enter Judas Iskariot mind, wey bi Simon pikin sey, make e sell Jesus give en enemy. Bikos Jesus know sey en Papa don gi-am pawa to kontrol evritin and as e bi sey e kom from God and e dey go back go meet am, e kon stand up for where dem dey chop, remove en big koat kon tie towel for en waist. E pour wota for basin, bigin dey wosh en disciples leg and dey dry dem with di towel wey dey en waist.
Wen e rish Simon Pita turn, Pita kon tell am, “Oga God, yu won wosh my leg?”
Jesus ansa, “Yu nor go fit undastand wetin I dey do naw, but yu go undastand am leta.”
Pita tell am, “I nor go gri make yu wosh my leg!”
Den Jesus ansa, “If I nor wosh yor leg, mi and yu nor go get anytin togeda again.”
So Simon Pita tell am, “Oga God, make yu nor wosh only my leg, but make yu wosh my hand and head too!”
10 Jesus ansa, “Di pesin wey don baf, only nid to wosh en leg, bikos e don dey klean. Una dey klean, but nor bi all of una.” 11 (Bikos Jesus know di pesin wey go sell am, naim make am sey, “Nor bi all of una dey klean.”)
12 So wen Jesus don wosh dia leg finish, e kon wear en big koat back. Den e go sidan for di tabol kon ask dem, “Una undastand wetin I do for una so? 13 Una dey koll mi ‘Tisha’ and ‘Oga God’, una korrect, bikos na so I bi. 14 So, if mi wey bi una oga and tisha, wosh una leg, e good make una wosh each oda leg too. 15 I don give una ezample wey una go follow. So make una do for each oda as I don do for una. 16 Make I tell una true word, savant nor dey big pass en oga, just as di pesin wey bi messenja nor dey big pass di oga wey send am. 17 Since una know wetin I dey tok, God go bless una, if una do dem.
Jesus Tok Who Go Sell Am
18 “Wetin I dey tok so nor koncern all of una, bikos I know di pipol wey I choose. Dis show sey God word na true sey, ‘Di pesin wey follow mi chop don turn to my enemy.’
19 “I don tell una before e go happen, so dat wen e happen, una go bilive sey na mi bi Christ. 20 I dey tell una true word, anybody wey receive di pesin wey I send, don receive mi and anybody wey receive mi, don receive God wey send mi kom.”
21 Wen e don tok dis tin finish, en heart kon heavy well-well, den e sey, “I dey tell una true word, one of una go sell mi give my enemy.”
22 Di disciples look each oda kon dey worry and tink for dia mind sey, “Wish pesin e dey tok about?” 23 John, di disciple wey Jesus love well-well, sidan for en rite hand wen dem dey chop. 24 So, Simon Pita kon use eye tell am sey make e ask Jesus wish pesin e dey tok about.
25 Den John bend en head near Jesus chest kon ask am, “Oga God, who yu dey tok about?”
26 Jesus ansa, “Na di pesin wey I go give dis bread afta I don shuk am inside di pot.” Den e shuk di bread inside di pot kon gi-am to Judas Iskariot, wey bi Simon pikin. 27 Afta Judas take di bread, devil enter en mind.
Jesus kon tell am, “Di tin wey yu won do, make yu go do am kwik-kwik.” 28 (No one among dem wey sidan for di tabol undastand why Jesus tok to Judas like dat. 29 Some of dem tink sey, since na Judas dey keep di money, Jesus tell am sey make e go buy wetin dem go use for di feast or make e give poor pipol money).
Jesus Sey Pita Go Deny Am
30 Wen Judas don take di bread, e hurry komot for di place. (By dis time, day don dark.) 31 Wen e don komot, Jesus kon sey, “Naw, di time don rish wen God go honor en pikin and en pikin go honor am too. 32 Wen di pikin don honor God, God go honor am too.
33 “My shidren, na small time remain wey I go dey with una. Leta, una go dey find mi and as I tell di Jew oga dem before sey, ‘Where I dey go una nor go fit kom der’, na di same word I dey tell una naw.
34 “I dey give una new kommand: Una must love each oda, as I love una, 35 so dat evribody go know sey, una bi my disciples if una love each oda.”
36 Simon Pita kon tell am, “Oga God, where yu dey go?”
Jesus ansa, “Una nor go fit follow mi go di place wey I dey go naw, but una go kom meet mi for der leta.”
37 Pita ask am, “Oga God, why wi nor go fit follow yu naw? I ready to die bikos of yu!”
38 Jesus ansa am, “Yu really ready to die for mi? Make I tell yu true word, before fawol go do ‘Kukuruku’ dis nite, yu go tok three times sey, yu nor know mi.”