29
Jeremaya Leta To Jew Pipol For Babilon
Dis na di leta wey I rite go give di priests, profets, leaders and all di oda pipol wey Nebukadnezzar karry as prisona from Jerusalem go Babilon. I rite am afta dem don karry King Jehoiashin, en mama, di ofisas for di palis, Judah and Jerusalem leaders and doz wey know work well-well, go Babilon. I give di leta to Eleasah wey bi Shafan pikin and Gemaraya wey Hilkaya born and na-im King Zedekaya for Judah send go meet King Nebukadnezzar for Babilon. Dis na wetin dey di leta:
“Israel God wey dey mighty dey tell di pipol wey Babilon king karry from Jerusalem go as prisona sey: ‘Make una build house kon setol down, den plant seeds and chop anytin wey e produce. Make una marry kon born shidren. Make una shidren marry kon born shidren too, so dat una go plenty for di land. Make una work well-well for di town wey I send una go as prisonas and make una pray make I bless dem, bikos if dem prosper, una go prosper too. Mi wey bi Israel God dey warn una. Make una nor let di profets wey dey stay among una or any oda pesin wey klaim sey e dey si tumoro, deceive una. Make una nor listin to dia dreams. Dem dey lie with my name, but I dey tell una naw sey I nor send dem kom meet una.’
10 “God sey, ‘Wen di seventy years wey I give Babilon don finish, I go kare and bring una kom back to una land, just as I promise. 11 Bikos I know wetin I plan for una; my plan na to make una prosper, nor bi to give una wahala and na to give una di kind future wey una dey hope to get. 12 Den una go koll my name kon pray give mi and I go ansa una. 13 Una go pray and woship mi with all una heart and I go dey with una. 14 Yes! I sey, una go find mi and I go bring una kom back to una land. I go gada una from evry kountry and place wey I skata una go and I go bring una kom back to di land wey I from send una go Babilon.
Mi, wey bi God, don tok.’
15 “Una sey, ‘God don give una profet for Babilon wey go give us good news.’ 16 But make una listin to wetin God tok about di king wey dey rule David kingdom and di pipol for di town wey bi una relashon, wey dem nor karry as prisonas follow una. 17 God wey dey mighty sey, ‘I dey bring war, honga and diziz kom meet dem and I go make dem bi like rotin fig fruit wey nobody fit chop. 18 I go use war, honga and diziz take porshu dem, sotey all di oda nashons for di world go shok, fear, laf and curse dem for anywhere wey I skata dem go, 19 bikos dem nor gri hear my word wey I dey always send go give dem thru my profets. 20 All of una wey I send go Babilon as prisonas, make una listin to wetin mi wey bi God dey tok.’
21 “Dis na wetin Israel God wey dey mighty tok about Ahab wey bi Kolaya pikin and Zedekaya wey Maaseaya born, wey dey lie for una with God name. God sey, ‘I don give dem to King Nebukadnezzar for Babilon and e go kill dem for una present.’ 22 So wen di pipol wey dem take from Jerusalem go Babilon won curse pesin, dem go sey, ‘Make God trit yu like Zedekaya and Ahab wey Babilon king roast alive!’ 23 Dis na wetin go happen to dem, bikos dem sin: dem sleep with dia neighbour wife kon lie with God name. God nor like all dis tins. E know wetin dem don do and wetin dem do dey stand against dem.”
Dis na wetin God tok.
Shemaya Leta
24 Israel God tell Jeremaya, “Make yu go tell Shemaya wey kom from Nehelam 25 sey di Oga wey bi Israel God wey dey rule di nashons get message for am. Tell am sey, ‘Just as yor mind tell yu, na so too yu send leta go give Zefanaya di priest wey Maaseaya born; di oda priests and all di pipol wey dey Jerusalem.’ For yor leta, yu tell Zefanaya sey, 26 ‘God don make yu priest instead of Jehoiada. E put yu for en temple so dat yu go dey kontrol doz kraze pipol wey dey pritend sey dem bi profets. And na yor work to tie dat kind pesin for groun. 27 But why yu neva do am to Jeremaya for Anatot, wey dey tell pipol sey e bi profet? 28 Bikos Jeremaya tell di pipol wey dey Babilon sey, dem go stay as prisonas for long time, so make dem build house, setol down, plant and chop anytin wey dem plant.’ ”
29 Zefanaya di priest kon read di leta give Profet Jeremaya. 30 Den God tell Jeremaya sey, 31 “Send message go give all di prisonas for Babilon about Shemaya. Mi wey bi God, go ponish Shemaya and all en shidren-shidren. I nor send am, but e tok to una as if en na profet and e make una bilive di lie wey e tell una. 32 Bikos e sey make my pipol go against mi, I go kill all en shidren-shidren and e nor go dey alive to si all di good tins wey I go do for my pipol.
Mi, wey bi God, don tok.”