30
God Promise En Pipol
Na Israel God wey dey mighty tell mi sey: “Make yu rite evritin wey I tell yu put for one book, bikos time dey kom wen I go bring my pipol, Israel and Judah kom back to di land wey I give dia grand-grand papa and e go bi dia own again.
Mi, wey bi God, don tok.”
God tell Israel and Judah pipol:
“I dey hear as una dey kry,
bikos of una fear and di wahala wey una dey face.
Naw, make una tink am well!
Man fit get belle kon born pikin?
So wetin make una men dey put dia hand for belle
like sey dem bi woman wey won born?
Wetin make evribody dey fear?
Di day wen una go face sirious wahala dey kom
and dem nor go fit kompare am with any oda day.
Even doh di wahala go too mush for my pipol,
dem go survive am.”
God sey: “Wen dat day go kom,
I go remove di load wey dey dia neck
kon break di shain
and dem nor go bi slave to strenjas again.
Dem go serve mi wey bi di Oga dia God
and na one of David shidren-shidren, go bi dia king.
10 My pipol, make una nor fear;
make Israel pipol nor fear at-all.
I go save una from di far land
where una dey as prisonas.
Una go kom back to una house
kon stay for peace and nobody go make una fear again.
11 I go save and dey with una.
I go distroy all di nashons where I skata una go,
but I nor go distroy una finish.
I go ponish una, but I go do am small-small.
Yes! I nor go let una go without ponishment.
Mi, wey bi God, don tok.”
12 God tell en pipol,
“Dem nor go fit cure una wound
and una sore go dey forever.
13 Nobody go kare for una or cure una sore;
una nor get hope at-all.
14 Doz wey love una, don forget una;
dem nor kare about una again,
bikos I don attack una like una enemy.
Una ponishment go sirious well-well,
bikos una wiked and don sin well-well.
15 Make una nor komplain about una sore again,
bikos e nor get cure.
I dey ponish una like dis,
bikos una wikedness and sin, too mush.
16 But naw, doz wey distroy una,
dem go distroy dem too
and dem go karry all una enemies
go Babilon as prisonas.
Dem go opress doz wey dey opress una
and doz wey tif from una,
dem go tif from dem too.
17 And even doh una enemies sey,
‘Zion nor mean anytin and nobody kare about am,’
I go make una well again kon heal una wound.
Mi, wey bi God, don tok.”
18 God sey,
“I go bring my pipol kom back to dia land
kon sorry for dem.
Dem go build Jerusalem again
and di king palis go dey as e bi before.
19 Di pipol wey dey stay der go sing,
praiz and dem go shaut for joy.
My blessing go make dem many well-well
and e go bring honor for dem.
20 Dia shidren-shidren go bi as dem bi before
and dem go always dey my present,
den I go ponish di pipol wey bin dey opress dem.
21 Dia leaders go kom from dia own nashon
and dia prince go bi dia own pipol.
E go kom meet mi wen I invite am,
bikos nobody go fit kom wen dem nor invite am.
22 Dem go bi my pipol
and I go bi dia God.
Mi, wey bi God, don tok.”
23 God vexnashon go kom like heavy breeze!
Like strong breeze wey go
blow wiked pipol head komot.
24 En vexnashon nor go stop
until E don do evritin wey E plan to do.
Afta sometaim, en pipol go undastand all dis tins.
One day, una go undastand wetin I mean.