Levitikus
Introdushon
Levitikus na di third book wey Moses rite. Dis na di law book wey God give Israel pipol wen dem kom from Egypt. God go guide en pipol until dem rish and enter Kanaan land wey E promise dem. Aldo, Levitikus nor only tok about only di works wey Levi pipol go do, but e still tok about di service for di Tabanako wey di priests and Aaron pikin dem dey do too and na Levi pipol dey assist dem. Na Exodus bin give di direcshon of how dem go take build di Tabanako and Levitikus give di laws and regulashon of how dem go take woship for der, plus di rules on how dem go take do all di sakrifice to klean diasef, di main laws, di days wey dey holy, di Sabat year and di Jubili year. Dem give dis laws wen Israel pipol dey for Mount Sinai for di wildaness and na God show Moses how Israel pipol, dia leaders and dia sojas go take dey woship.
1
Sakrifice Law
God koll Moses kon tell am from di Tabanako sey: “Make yu go tell Israel pipol sey, ‘Wen anybody one sakrifice animal give God, e fit use en kattle, sheep or goat.
Burnt Ofrin
“ ‘If na burnt ofrin from en animals, e must bring man own wey dey okay kom Tabanako, so dat God go asept am. E go put en hand for di animal head and God go asept am as sakrifice to take forgive en sin.’ Den e go kill di animal for der and di priests wey bi Aaron sons go give God di blood kon put am for di four side for di altar wey dey for di tent gate. Den di pesin wey dey give di ofrin go remove di animal skin kon kut am small-small and di priests go arrange and lite firewood near di altar. Dem go put all di animal part for inside, plus di head and di fat. Di man wey dey give di ofrin must wosh di animal intestine and legs and di priest go burn evritin for di altar. God like dis food ofrin smell well-well.
10 “ ‘If di man dey give one sheep or goat, e must bi man own wey dey okay. 11 E go kill-am for di nort side for di altar and di priest go put di animal blood for di four side for di altar. 12 Afta di man don kut am small-small, di priest go kon put all di animal part, plus en head and fat for fire. 13 Di man wey dey give di ofrin must wosh di animal intestine and legs, den di priest go burn evritin for di altar. God like dis food ofrin smell well-well.
Bird Ofrin
14 “ ‘If di man one give bird as burnt ofrin, e must bi dove or pijin. 15 Di priest must offa am for di altar, e go twist en neck kon burn en head for di altar. E go remove di blood kon put am for di altar side. 16 E go remove di intestine and all di tins wey dey inside kon trowey dem for di east side for di altar where dem dey put di ashes. 17 E go hold di feada kon tear di body open. E nor go allow di feada fall komot, den e go burn evritin for di altar. God like dis food ofrin smell well-well.