2
Korn Ofrin
“ ‘Wen una dey give korn ofrin to God, una must first grind am to powder. Una must put olive oil and incense on-top kon take am go give Aaron sons wey bi priest. Di priest go pak di flower, oil and all di incense full en hand kon burn am for di altar as part of di ofrin wey dem give God. God like dis food ofrin smell well-well. Di remainin korn ofrin na di priests own; e dey holy, since dem remove am from di food wey dem give God.
Ofrin Wey Dem Bake
“ ‘If di ofrin na bread wey dem bake for oven, den dem must nor make am with yist. E fit bi tick bread or biscuit wey dem make with flower kon mix am with olive oil. If di ofrin na bread wey dem kook for iron plate, dem go make am with flower wey dem mix with olive oil, but make e nor get yist. Make dem grind am to pieces kon pour olive oil inside, bikos na korn ofrin. If di ofrin na bread wey dem kook for plate, dem must make am with flower and olive oil.
“ ‘Make una bring am to di priest as ofrin for God and di priest go take am go di altar. Di priest go take some for inside kon burn am for di altar. God like dis food ofrin smell well-well, bikos e dey special. 10 Di remainin ofrin na di priest own; e dey holy, bikos dem take am komot from di food ofrin wey dem give God.
11 “ ‘Make una nor give God korn ofrin wey dem make with yist; una must nor make di food ofrin wey una go give God with yist or honey. 12 Una go give God ofrin from di first korn wey una harvest each year, but una nor go burn am for di altar. 13 Make una put salt for all una korn ofrin, bikos di salt dey show di kovenant between una and God.
14 “ ‘Wen una dey bring di ofrin wey una get from di first korn wey una harvest, make una give korn wey dem roast and food wey dem grind. 15 Make una put olive oil and incense on-top. 16 Di priest go burn di part for di food and di oil wey e take, plus all di incense and dem go bi food ofrin to God.