13
Skin Diziz
God tell Moses and Aaron: “If anybody get sore, boil or spot and e turn to diziz for en skin, dem must karry am go meet Aaron wey bi di priest or en sons. Di priest go look di sore and if di hair wey dey en skin don turn white and di sore deep well-well pass di skin, di priest go sey di pesin nor dey klean.
White Skin
“But if di sore dey white and e nor deep pass di skin and di hair neva shange to white, di priest go separate di pesin from oda pipol for seven days. Di priest go look am again for di sevent day and if e feel sey di sore still bi as e bi before, e go separate am for anoda seven days. Di priest go look am again for di sevent day and if di sore don dey go, e go kon sey e dey klean; bikos na only sore e get. Di pesin go wosh en klot and e go dey klean. But if di sore spread afta di priest don look am sey e klean, e must go meet di priest again. Di priest go look am again and if e si sey e don spread, e go sey e nor dey klean, bikos na diziz e get.
Skin Wey Dey Swell-up
“If anybody get diziz for en skin, dem go take am go meet di priest and 10 e go look am. If white sore dey di skin wey turn di hair to white and e get plenty pus, 11 na sirious diziz e get for en skin. Di priest go sey e nor dey klean.
12 “If di diziz for di skin spread kover all en body, 13 di priest go look am again. If e si sey e don really kover en whole body, e go kon sey di pesin klean. If all en skin turn to white, den e dey klean. 14 But if new sore bigin show, den e nor dey klean. 15 Di priest go look am again and if e si new sore wey open for en skin, e go sey e nor dey klean. Sore wey open mean skin diziz wey fit kill pesin. So di pesin nor dey klean at-all. 16 But wen di sore don heal and e don turn white back, di pesin go-go meet di priest, 17 wey go look am again. If di sore don turn white, den di priest go sey e don klean.
Boil For Skin
18 “If anybody get boil wey don heal, 19 den di boil kon swell-up and white or red-white spot kon appear for where di boil dey before, e go-go meet di priest. 20 Di priest go look am and if di spot deep pass di skin wey near where di boil dey and di hair dem wey dey der kon turn white, e go sey di pesin nor dey klean. Na skin diziz wey dem dey fear well-well. 21 If di priest look am kon si sey di hair wey dey der neva turn white and e nor deep pass di skin, but e get lite kolour, di priest go separate di pesin from oda pipol for seven days. 22 If di spot spread, di priest go sey di pesin nor dey klean; e get diziz. 23 But if e nor shange or spread and na only di mark dey show, di priest go sey e dey klean.
Burn-burn Skin
24 “Wen sometin like fire burn pesin, if di flesh shange to white or red-white, 25 di priest go look am. If di hair for di spot don turn white and e deep pass di skin wey dey near am, den dat na skin diziz wey pipol dey fear well-well and di priest go sey e nor dey klean. 26 But if di hair for where di spot dey turn white and e nor deep pass di skin wey dey near am, but e get lite kolour, di priest go separate am from oda pipol for seven days. 27 Di priest go look am again for di sevent day and if e dey spread, di priest go sey e nor dey klean. 28 But if di spot nor shange, spread and e get lite kolour, den nor bi skin diziz. Di priest go sey e dey klean, bikos na just mark from di fire wey burn am.
Mark For Head
29 “Wen man or woman get sore for head or for di bear-bear side, 30 di priest go look am. If e deep pass di skin wey dey near am and di hair dem dey yellow and tin, den dat na skin diziz wey pipol dey fear well-well, so di priest go sey di pesin nor dey klean. 31 If di priest look am kon si sey di sore nor deep pass di skin wey dey near am and e nor get black hair, di priest go separate am from oda pipol for seven days. 32 Di priest go look di sore again for di sevent day, if e neva spread or yellow and e nor deep pass di skin wey dey near am, 33 den di pesin go barb en hair kon leave only di place where di sore dey. Di priest go separate am from oda pipol for anoda seven days. 34 For di sevent day, di priest go look di sore again and if e neva spread and e nor deep pass di skin wey dey near am, di priest go sey di pesin dey klean. So e go wosh en klot kon dey klean. 35 But if di sore spread afta di priest don sey e dey klean, 36 di priest go look am again. If di sore don spread, e nor nid to look for hair wey yellow; di pesin nor dey klean bi dat. 37 But if di priest feel sey di sore neva spread and black hair dey grow for inside, dat mean sey di sore don heal, den di pesin don klean.
White Skin
38 “Wen man or woman get white spot for en skin, 39 di priest go look di pesin. If di white spot wey dem get for body na white wey don fade, den na rashes from di pesin skin and e dey klean.
Pesin Head
40 “If man nor get hair for back of en head, e dey klean. 41 If man nor get hair for front of en head, e dey klean. 42 But if rashes wey dey red dey for di back or di front wey hair nor dey, den dat na diziz. 43 Di priest go look am, if di diziz na di one wey dey red and white for di back or for di front where hair nor dey, 44 den di man don get strong diziz bi dat. E nor dey klean. Di priest must sey di man nor dey klean, bikos of di diziz wey dey en back head.
Pesin Wey Get Skin Diziz
45 “As for di pesin wey get di diziz, dem must tear e klot; nor komb en hair and e go kover en face dey shaut sey, ‘I nor dey klean! My body dirty well-well!’ 46 As long as e get dis diziz, e go dey unklean and una go keep am for where pipol nor dey-dey for outside di kamp.
Unklean Garment, Klot Or Leda
47 “Wen klot get diziz, weda na wool or linen klot, 48 or any pieces of linen or wool, or di leda or anytin wey dem take leda make, 49 if di diziz wey dey di klot or leda na yellow wey dey green or red, den dem must show di priest. 50 Di priest go look di tins well-well kon keep am for outside for seven days. 51 E go shek am again for di sevent day. If di diziz don spread for di klot, wrapa or leda, den di klot nor dey klean bi dat. 52 Di priest go burn am with fire, bikos of di diziz wey spread for di klot.
53 “But wen di priest shek and di diziz neva spread for di klot, 54 e go sey make dem wosh and keep am for anoda seven days. 55 Den e go look am again, if di diziz neva shange kolour, even if e nor spread e go still dey unklean; den una must burn di klot, weda di stain dey for back or front. 56 But if di priest look kon si sey di diziz don fade, e go tear dat part komot for di klot or di leda. 57 Den if di diziz kom back kon spread again, di pesin wey get di klot go burn am. 58 If e wosh di klot and di spot dem komot, e go wosh am again and e go dey klean.”
Konklusion
59 Dis na di law about diziz wey dey inside klot, weda na wool, linen or leda and na like dis dem go take know weda e dey klean or not.