14
To Santify Pesin
God tell Moses: “For di day wen di priest won klean di pesin wey bin get diziz, dis na di tins wey e go do. Di priest go-go outside di kamp go look di pesin. If di pesin wey get di diziz don dey okay, di priest go orda sey make dem bring two klean bird, part for cedar wood, red rope and some hyssop leaf. Di priest go orda sey make dem kill one bird put for klay pot wey dem just fetch wota put. Di bird wey dem kill and put en blood for klean wota, di priest go take di oda bird with di cedar wood part, di red rope and hyssop leaf kon deep dem inside am. Den e go sprinkol am seven times for di pesin wey dem dey santify kon sey e dey klean and e go let di bird wey dey alive fly go outside di town for di open field.
Seven Days For Kleanin
“Di pesin go wosh e klot, barber en hair kon baf; den e go dey klean. E go fit enter di kamp, but e go stay outside en house for seven days. For di sevent day, e go barber en hair again, en bear-bear, di hair wey dey en eye and all di hair wey dey en body. E go still wosh en klot kon baf, den e go dey klean.
Di Eight Day
10 “For di eight day, e go bring two man lamb and one woman own wey bi one year and dem must dey okay and if dem divide flower bag into ten, e go bring three part wey dem mix with olive oil. If dem divide one lita for olive oil into ten, e go bring three part kom. 11 Di priest go take di pesin and di ofrin go di tent for God present. 12 Di priest go take one man lamb with di olive oil kon offa am as guilt and sin ofrin to God. 13 Den e go kill di man lamb for di place where dem for dey kill lamb for sin and burnt ofrin. E must do dis tin, bikos na di priest get di sin and guilt ofrin and dem dey holy. 14 Den di priest go take some blood for di lamb kon put am for di pesin wey dem dey santify rite ear; en big finger for en rite hand and en big toe for en rite leg. 15 Di priest go take some olive oil pour for en left hand, 16 deep en rite finger inside, den dem go sprinkol am seven times for God present. 17 E go take some oil wey dey en hand and some blood for di lamb kon put dem for di pesin wey dem dey santify rite ear; di big finger for en rite hand and di big toe for en rite leg. 18 E go put di remainin oil wey dey en hand for di pesin head. Na like dis di priest go take make di pesin dey holy for God eye. 19 Di priest go offa di sin ofrin kon beg God for di pesin wey dem dey santify and afta dat one, e go kill di animal for di burnt ofrin 20 kon offa di burnt and korn ofrin for di altar. So di priest go beg God for am and e go dey holy.
Poor Pesin
21 “If di pesin dey poor and e nor get money, e go bring only one special man lamb as en ofrin to God and na di priest get am. E go bring one kilogram of flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin and three lita of olive oil. 22 E go still bring two dove or two pijin, one for di sin ofrin and one for di burnt ofrin. 23 For di eight days wey e go take klean ensef, e go give di priest all dis tins for di tent gate. 24 Di priest go take di lamb and di olive oil as special gift to God. 25 E go kill di lamb kon take some of di blood put for di pesin rite ear, en big finger for en rite hand and di big toe for en rite leg.
26 “Di priest go pour some oil for en left hand 27 and with one finger wey dey en rite hand, e go sprinkol am seven times for God present. 28 E go put some of di oil for di same place just as e put di blood before for di pesin rite ear, di big finger for en rite hand and for di big toe for en rite leg. 29 E go put di remainin oil wey dey en hand for di pesin head and like dis, e dey make di pesin holy. 30 Den e go offa one dove or pijin 31 as sin ofrin and di oda go bi for burnt ofrin with di korn ofrin. Like dis, di priest go beg for di pesin wey e dey santify before God. 32 Dis law na for poor pesin wey get diziz, wey nor fit pay or do di normal ofrin.”
House Wey Nor Klean
33 God tell Moses and Aaron: 34 “Wen una don enter di land wey dey Kanaan wey I go give una to stay and I kon put diziz for di house wey una won stay, 35 den who get di house go kom show ensef to di priest sey, ‘I si sometin wey bi like diziz for my house.’ 36 Den di priest go orda sey make dem santify di house before di priest go enter go look am. 37 E go look di diziz and if di diziz wey dey di wall for di house dey yellow, green or red, 38 e go leave di house kon lock am for seven days. 39 For di sevent day, e go-go back go look am again. If di diziz don spread, 40 e go orda make dem remove di stones wey di diziz dey and dem go trow am for outside di town. 41 Afta dat, e go klean di wall kon trow di dirty outside di town. 42 Dem go use anoda stone take shange di stones wey dem remove, den dem go plasta di wall.
43 “If di diziz kom out again afta dem don remove di stone kon plasta am, 44 di priest go-go look am, if di diziz don spread, den di house nor dey klean bi dat. 45 Dem must distroy di house, en stones and wood kon trow dem outside di town. 46 Anybody wey enter di house for di time wey dem lock am go dey unklean till evening. 47 Anybody wey liedan or chop for di house must go wosh en klot. 48 If di priest kom look and di diziz nor kom back again afta dem don plasta di wall, e go sey di house dey klean, bikos di diziz don go. 49 To santify di house, e go take two birds, cedar wood, red rope and hyssop leaf 50 kon kill one of di bird put inside klay pot wey dem just fetch wota put. 51 E go take di cedar wood, di red rope, di hyssop leaf and di bird wey dey alive, deep dem inside di blood kon sprinkol am for di house seven times. 52 Like dis, e go santify di house from di diziz with di bird blood; di klean wota; di bird wey dey alive, di cedar wood, di hyssop leaf and di red rope. 53 E go let di bird wey dey alive fly go outside di town for di open field. Na like dis di priest go take santify di house and e go dey klean.
Konklusion
54 “Dis na di law for skin diziz; 55 diziz for klot and house; 56 di ones wey swell-up for body and di spot wey dem dey si. 57 Dis law na to know wetin dey klean or not.”