21
Law For Priest
God tell Moses: “Make yu tell di priest wey bi Aaron sons sey, ‘For pesin wey don die, make any priest nor go dirty ensef bikos e go di burial. But if di pesin dey klose to am like en: mama, papa, sista, broda, and en sista wey bi virgin wey nor get husband, e fit go. E must nor dirty ensef for somebody wey rilate to am only thru marriage. Make di priest nor barb any part for en head, shave en bear-bear or kut en body. Dem must dey holy to dia God and nor disgrace my name, bikos na dem dey offa food ofrin to mi. Bikos di priests dey holy, dem must nor marry ashawo or woman wey nor bi virgin or woman wey leave en husband. Di pipol must si di priest as pesin wey dey holy, bikos na-im dey give di food ofrin to mi. I dey holy and I dey make my pipol holy. If priest dota turn to ashawo, e dey bring disgrace for en papa; so dem go burn di girl.
Law For High Priest
10 “ ‘Wen dem don pour di anointin oil for High Priest head, e don dey klean to wear di garment wey priests dey wear and e must nor komb en hair or tear en garment. 11 E must nor go where dead body dey; e must nor make ensef unklean even for en papa or mama. 12 E must nor komot from di temple or enter where dead body dey, even if na en papa or mama die, bikos e don dey holy thru God anointin oil. Na mi bi Oga God. 13 Na only virgin di High Priest go fit marry. 14 E nor go marry woman wey en husband don die or wey leave en husband or woman wey dey do ashawo. En wife must bi virgin from en family. 15 If not, en shidren wey suppose dey holy go kon dey unklean. Na mi bi God and I don separate am as my High Priest.’ ”
Law For All Priest
16 God tell Moses: 17 “Go tell Aaron sey, ‘Make no man from en family wey get diziz, offa food ofrin to God. 18 Make nobody wey get diziz go offa food ofrin: dat is, doz wey blind, cripple, wey get sore or wey en body nor komplete; 19 man wey en hand and leg break; 20 man wey get hunch-back or man wey bi dwarf; man wey get diziz for eye or for en body and man wey nor gri marry. 21 Make nobody from Aaron family wey get diziz go offa food ofrin to God. 22 Di pesin fit chop di food wey dey holy well-well and di holy food wey bi God own, 23 but e nor go enter di holy curtain or kom near di altar, bikos e get diziz. So e nor go offa dis tins, bikos na mi bi God and I don make dem dey holy.’ ” 24 So dis na wetin Moses tell Aaron, en sons and all di pipol for Israel.