22
Priest Food
God tell Moses: “Make yu tell Aaron and en sons sey make dem nor disgrace my name wey dey holy, but make dem trit di holy ofrin wey Israel pipol offa give mi with respet. Na mi bi God. Make yu tell dem sey, ‘If una pikin wey nor klean go near di holy ofrin wey Israel pipol offa give mi, den una go remove am from my pipol. Dis na wetin dem go do forever. Na mi bi God. Nobody from Aaron family wey get diziz or dey discharge go chop di holy ofrin until e don dey holy. Pesin wey tosh anytin wey nor klean, bikos di tin tosh pesin wey don die; man wey dey discharge; man wey tosh animal or pesin wey nor dey klean; go dey unklean till evening. E nor go fit chop anytin among di holy ofrin, escept e first go baf. Wen di sun don go down, e go dey klean, den e fit chop di holy ofrin, bikos na-im food. E nor go chop any animal wey die on en own or wey anoda big animal kill, bikos e go make am unklean. Na mi bi di Oga una God. All di priest must keep my law, so dat dem nor go sin kon die bikos dem disobey. Na mi bi God wey make una holy.
10 “ ‘Na only pesin wey kom from di priest family go chop from di holy ofrin; nobody go fit chop dem! Pipol wey dey stay with am or anybody wey e hire to work for am nor go follow am chop. 11 But di priest slave wey e buy or wey dem born for en house go fit chop di food wey dem give di priest. 12 Di priest girl pikin wey marry who nor bi priest nor go chop for di holy ofrin, 13 but if di priest girl pikin husband don die or e don leave en husband and e nor born any pikin kon go back to en papa house, den e fit chop from e papa food, but no strenja go chop am. 14 If anybody chop ofrin wey dey holy and e nor know, e go add twenty percent join wetin e chop kon gi-am to di priest. 15 Dem must nor spoil di holy ofrin wey Israel pipol offa to God, but 16 if anybody wey nor suppose to chop am, chop am, e don bring wahala to ensef. Na mi bi God and I don make di ofrin holy.’ ”
Free Ofrin
17 God tell Moses: 18 “Make yu tell Aaron, en sons and Israel pipol sey, ‘Wen anybody from Israel pipol house or strenja dey give dia burnt ofrin; weda na to pay vow or na from dia mind, 19 If I go kollect am, den di animal wey dem go offa weda na kattle, sheep, or goat must dey okay. 20 Una must nor offa anytin wey nor dey okay, bikos I nor go asept am.
21 “ ‘If anybody won offa peace ofrin give God, weda na vow or na from en mind, di animal wey dem go use, must dey okay, so dat I go asept am. 22 Any animal wey blind, wey nor dey waka, get problem, sore or skin wey dey tear, make una nor offa am give God as ofrin. 23 Una fit offa animal wey short or wey neva mature as ofrin from una mind, but I nor go asept am if una use am take pay for una vow. 24 Make una nor give God any animal wey en private part get sore, kut, get mark or kut komot. Una must nor do dis tins for una land. 25 Make una nor offa any animal wey una get from strenja as food ofrin to God, bikos dat kind animal nor dey klean and I nor go asept dem.’ ”
26 God tell Moses: 27 “Wen dem just born lamp, melu or goat, e go dey under en mama for seven days, but for di eight day go, dem fit use am as gift ofrin to God and I go asept am. 28 Una nor go kill melu or sheep and en small pikin togeda for di same day. 29 Wen una dey offa tanksgivin sakrifice to God, una must follow di rule, so dat I go asept am from una. 30 Make una chop am for dat same day and no one must remain till di next morning. 31 Make una try to do all my kommandment. Na mi bi Oga God. 32 Make una nor disgrace my holy name, bikos I go show as I dey holy among Israel pipol. Na mi bi God wey make una dey holy 33 and na mi karry una komot from Egypt, so dat I go bi una God. Na mi bi Oga God.”