23
Woship Time
God tell Moses: “Make yu tell Israel pipol sey, ‘Dis na di day wey God choose for di festival and una go dey do am wen evribody gada to woship.
Sabat Day
“ ‘Una go work for six days, but di sevent day, na di day wey una suppose rest. For dat day, una nor go work, but una go gada woship God.
Passova And Bread Feast
“ ‘Make una do all dis festival for di time wen God tok. For di first mont for di fourteent day for evening, una go celebrate di Passova to honor God. Di Fifteent day for di mont go bi di bread wey nor get yist feast and una nor go chop bread wey dem make with yist for eleven days. For di first day, una go gada woship and una nor go do any work. Una must offa gift to God for seven days and for di sevent day, una go gada again kon woship God, but una nor go do any work.’ ”
First Fruit
God tell Moses: 10 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘Wen dem enter di land wey I won give dem kon harvest dia korn, make dem take di first ones wey dem harvest go give di priest. 11 E go offa am as special ofrin to God, so dat I go asept am. Na di day afta Sabat Day, di priest go offa am. 12 For di day wey una go offa di korn ofrin, una go sakrifice man lamb wey dey okay as burnt ofrin to God. 13 With di lamb, una go offa two kilogram of flower wey dem mix with olive oil for food ofrin. God like dis ofrin smell. Una go offa am togeda with one lita of wine. 14 Make una nor chop any new korn, weda raw one or di one wey dem roast or bake to bread, until una don bring di ofrin kom meet God. Una shidren wey una go born go obey dis law forever and ever.
Week Feast
15 “ ‘Una must kount seven weeks from di day afta di Sabat Day, wen una bring di first korn wey una harvest kom give God. 16 Una must kount fifty days until di day afta seven Sabat Day don pass, den una go give God anoda new korn ofrin. 17 Each family go bring two bread and dem go offa dem give God as special gift. Dem go make each bread with two kilogram of flower; bake dem with yist kon offa am to God as ofrin from di first korn wey dem harvest. 18 Una must offa seven lamb wey bi one year, one small melu and two rams, join di bread. Dem go bi burnt ofrin to God with dia korn and drink ofrin and God like dis gift. 19 Una go offa man goat for sin ofrin and lamb wey bi two years for peace ofrin. 20 Di priest go offa di bread and di two lamb as special gift to God. Dis ofrin dem dey holy. 21 For dat day, una nor go do una evriday work, but una go gada togeda woship mi. Una shidren go dey obey dis law forever. 22 Wen una gada di harvest from una land, make una nor harvest evritin for di land finish and una must nor gada evritin for una harvest. Make una leave some for poor pipol and strenjas. Na mi bi di Oga una God.’ ”
Trumpet Feast
23 God tell Moses: 24 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘For di first day for di sevent mont, una go rest well-well and una must kom togeda kon woship mi wen una hear di trumpet sound. 25 Make una nor do any work, but una must give special ofrin to God.’ ”
Day To Ask God To Forgive
26 God tell Moses: 27 “Di tent day for di sevent mont go bi di day to pray make God forgive una. Una go gada woship and una nor go chop anytin, but una go give ofrin to God. 28 Una nor go do any work for dat day, bikos na di day to pray make di Oga una God forgive una. 29 Anybody wey chop anytin for dat day, nor go dey among God pipol again. 30 And if anybody do any work for dat day, God go use en own hand kill-am. 31 Dis na di law wey all una pikin must obey, no matter where dem dey. 32 Dat day na Sabat Day, so una must rest and una must honbol unasef for di ninet day for di mont for evening and from dat evening still di next morning, una must respet di Sabat Day.”
House Feast
33 God tell Moses: 34 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘For di Fifteent day for di sevent mont, dem must use seven days take do di house feast for God. 35 Di first day na to woship am; den una nor go do any work. 36 For seven days, una must offa gift to God. For di eight day, una go gada woship kon give ofrin to God. Na di day for woship and una nor go do any work. 37 (Dis na di holy festival wey una go use take honor God as una gada dey woship and give ofrin to am. Dis ofrin na burnt and korn ofrin; sakrifice and drink ofrin for each day akordin to wetin God tok. 38 Dis festival join di normal Sabat Day and dis ofrin dem join di normal gift ofrin. Dis na ofrin to take do una vow and di ones wey una give God from una mind.)
39 “ ‘Wen una don harvest wetin una plant for una land, make una celebrate dis festival for seven days and e go start for di Fifteent day for di sevent mont. Di first day go dey special, so una go rest. 40 For dat day, una go take some of di good fruit from una tree, palm tree branches wey get leaf well-well kon celebrate to honor God. 41 Una must celebrate for seven days. Una shidren-shidren must keep dis law forever. 42 Make una stay for anoda place for seven days; all of una wey kom from Israel must stay der, 43 so dat una shidren-shidren go know sey na mi give una house afta I take una komot from Egypt. Na mi bi di Oga una God.’ ”
44 So Moses tell Israel pipol evritin wey God tok.