6
Wen Pesin Disobey
Den God tell Moses: “If pesin sin against God wen e nor gri riton wetin e take as shorti from anoda pesin or wen e tif or play wayo, or e si sometin wey lost kon lie and swear sey e nor si am, e must give ofrin. If any man kommit dis kind sin, evritin wey e get thru wayo or lie-lie, e go must riton dem. Di day wey e dey riton dem, e go pay di owner komplete money kon add twenty percent join am. Den e go take en sin ofrin go give God thru di priest and e go bring ram wey dey okay and wey dem go fit shange to silva shekel for en sin ofrin. As di priest offa dis sakrifice, di man go dey good for God eye again and God go forgi-am.”
Sakrifice Law For Di Priest
God tell Moses: “Make yu kommand Aaron and en sons sey, ‘Dis na di burnt ofrin law. Dem go leave di burnt ofrin on-top di altar till day break and di fire go kontinue to dey burn. 10 Den di priest go wear e linen robe and nika, remove di ashes for di fire wey dey di altar kon put dem near di altar. 11 Den e go shange en klot kon take di ashes go one klean place for outside di kamp. 12 But di fire wey dey di altar must kontinue to dey burn. Make dem nor kwensh am. Evry morning, di priest go put firewood on-top di fire, e go arrange di burnt ofrin on-top am kon burn di fat for di peace ofrin. 13 Di fire must kontinue to dey burn on-top di altar and dem nor go let am kwensh.
Korn Ofrin For Ordinary Pesin
14 “ ‘Dis na di law for korn ofrin. Aaron sons go present am before God for di altar front 15 and di priest go pak some of di flower, di oil and di incense for di top kon burn am on-top di altar as sakrifice to God. God dey like dis ofrin smell. 16 Aaron and en sons go chop di remainin ones. Dem go take am make bread wey nor get yist kon chop am for di Holy Place where God Temple dey. 17 Dem must nor make di bread with yist. I don gi-am to dem as gift. E dey holy well-well like di one for sin and guilt ofrin. 18 Evry boy pikin wey Aaron born, must chop am. Na dis go always bi dia share wen ever dem offa ofrin to God. God go ponish anybody wey tosh di food ofrin, bikos e dey holy.’ ”
Korn Ofrin For Di Priest
19 Den God tell Moses: 20 “Dis na di ofrin wey Aaron and en sons go present to God for di day wey dem go anoint dem: One kilogram of flower (di same amount as evriday korn ofrin), half for morning and half for evening. 21 Dem go mix am with oil kon kook am with iron plate. Dem go soak am well-well, before dem go bring am kom. So una go present am as korn ofrin, di kind smell wey God dey like well-well. 22 Di priest wey go take-ova from Aaron among en sons, go always dey do am. Na God get am and dem go burn am komplete. Dis law na forever. 23 Dem nor go chop any part for di korn ofrin wey di priest make; dem must burn all of dem finish.”
Sin Ofrin
24 Den God tell Moses: 25 “Make yu tell Aaron and en sons sey, ‘Dis na di law for sin ofrin. For di place where dem take kill di animal for di burnt ofrin for di nort side for di altar, na der dem go still take kill di animal for sin ofrin. Dis ofrin dey holy to God. 26 Di priest wey sakrifice di animal go chop am for di Holy Place inside God Temple where dem for dey meet. 27 Anybody wey tosh di animal meat must dey holy and anybody wey di animal blood stain en garment or di Holy Place, must wosh am. 28 Dem must break di klay pot wey dem take boil di meat, but if dem use iron pot, dem go wosh am well-well kon rinse am with wota. 29 Di men among di priest family fit chop dis ofrin, bikos e dey holy. 30 But if dem karry di blood enter God Temple kon use am as sakrifice to remove sin, dem nor go chop di animal at-all; dem must burn am finish.’ ”