7
Guilt Ofrin
God still tell Moses, “Dis na di law for guilt ofrin and e dey holy. Una go do di guilt ofrin for di nort side for di altar, where dem for dey do di burnt ofrin kon rub di blood for di four side for di altar. Una go remove all di fat wey dey di animal kon offa am to God for di altar: di fat tail, di fat wey kover di intestine, di two kidney and dia fat and di best part for di liver. Di priest go burn all di fat for di altar as food ofrin to God. Na dis bi di guilt ofrin. Anybody wey kom from di priest family fit chop am. Dem must chop am for di Holy Place, bikos e dey holy. Dis law na di same for both sin and guilt ofrin: na di priest wey sakrifice am get di meat.
Di Priest Part For Di Ofrin
“Di animal skin wey dem give as burnt ofrin na di priest wey sakrifice am, get am. Evry korn ofrin wey dem bake for oven, pan or iron plate, na di priest wey offa am to God, get am. 10 But korn ofrin wey dem nor kook, weda dem mix am with oil or dry am, na Aaron sons get am and dem must share am among dem.
Peace Ofrin
11 “Dis na di law for di peace ofrin wey dem sakrifice give God. 12 If anybody tank God with dis ofrin, e go still bring bread wey dem nor make with yist: weda di bread strong or dem mix am with olive oil. E fit bi biscuit wey dem rub olive oil put or kake wey dem make with flower kon mix am with olive oil. 13 E go still give bread wey dem bake with yist for dis ofrin too. 14 E go give one part for each bread as special ofrin to God; na di priest wey take and rub di animal blood for di altar, get am. 15 Dem must chop di meat for di same day wey dem sakrifice am; no meat must remain till di next morning.
16 “If anybody bring peace ofrin to take pay en vow or e do am from en mind, nor bi all of dem una go chop di day wey e gi-am, but dem fit chop di remain wons for di next day. 17 But dem must burn di meat wey remain for di third day. 18 If dem chop any one for di third day, God nor go asept di man ofrin. God nor go favor en and di ofrin, bikos e nor dey klean and anybody wey chop am go sofa di ponishment.
19 “If di meat tosh wetin nor dey klean, den una must nor chop am; una must burn am for fire. But meat wey dey klean, evribody wey dey klean fit chop am, 20 but if pesin wey nor dey klean go chop am, e nor go dey among God pipol again. 21 If anybody tosh wetin nor dey klean, (weda na human being, animal or anytin) den kon chop dis ofrin meat wey dem give God, dem go remove di pesin from di kommunity.”
Sakrifice Law For Ordinary Pesin
22 God tell Moses: 23 “Make yu go tell Israel pipol sey, ‘Make una nor chop di fat wey dey kattle, sheep or goat. 24 Una must nor chop animal wey just die on en own or wey wiked animal kill, but una fit use di dead body do anoda tin. 25 Anybody wey chop animal wey dem offa as food ofrin to God, nor go dey among God pipol again. 26 E nor matter where Israel pipol dey stay, dem must neva use bird or animal blood take do food. 27 Anybody wey break dis law nor go dey among God pipol again.’ ”
Priest Part For Peace Ofrin
28 God kon give Moses dis laws: 29 “Go tell Israel pipol sey, ‘Anybody wey give peace ofrin must bring part of am as special gift to God. 30 E go bring am with en own hand as food ofrin. E go bring di animal fat with en breast kon gi-am as special gift to God. 31 Di priest go burn di fat for di altar, but di breast go bi di priest own. 32 E go give di animal rite leg as special kontribushon 33 to di priest wey give di blood and di fat as peace ofrin. 34 Di animal breast na special gift and di rite leg na special kontribushon wey God don take from Israel pipol kon gi-am to di priests. Dis na wetin Israel pipol go give di priests forever. 35 Dis na part for di food wey dem give God, Aaron and en sons for di day wey dem make dem priest. 36 For dat day, God kommand Israel pipol make dem give dem dis part from di ofrin. Na law wey Israel pipol must obey forever.’ ”
37 Dis na di law for di burnt, korn, sin, guilt, ordinashon and di peace ofrin. 38 For Mount Sinai, God kon give dis kommand to Moses for di day wey e tell Israel pipol to give dia ofrin.