2
Wise Men Kom Salot Jesus
Afta dem born Jesus for Betlehem wey dey Judea, for di time wey Herod bi king, some wise men from east kon go Jerusalem dey ask, “Where di Jew king wey dem just born? Wi si di star wey tok about am, so wi kom woship am.”
Wetin dem tok so, vex King Herod and Jerusalem pipol. So, di king gada all di priest oga dem and di pipol wey sabi di law kon ask dem, “Where una tink sey dem go for born Christ?” Dem kon ansa, “Na for Betlehem, wey dey Judea, just as Profet Isaya rite sey:
“ ‘Betlehem pipol,
una wey small pass for all di pipol wey dey rule Judah,
na from among una di pesin
wey go lead all my pipol for Israel,
go from kom.’ ”
Den Herod koll di wise men go korna, make dem for tell am wen dem si di star. E kon sey, “Make una go look for di pikin well-well. Wen una don si am, make una kom tell mi, so dat mi too, go-go woship am.”
Wen di king tok finish, di wise men kon dey go and di star wey dem si before, kon dey lead dem until e stop on-top di house where di pikin dey. 10 Wen dem si di star, dem kon dey happy. 11 Dem enter di house, si di pikin with en mama kon knee down woship am. Den dem open dia bag kon gi-am some gifts wey bi, gold, frankincense and myrrh. 12 Bikos God warn dem for dream make dem nor go back go meet Herod, dem kon pass anoda road go dia house.
Josef And En Family Run Go Egypt
13 Wen di wise men don go, God angel kon tell Josef for dream, “Get up, karry di pikin and en mama run go Egypt, make una stay der until I go tell yu wetin una go do, bikos Herod won kill di pikin.” 14 Dat same nite, Josef wake-up, karry di pikin and en mama kon run go Egypt. 15 Dem stay der till Herod die. Dis tin make wetin God profet tok happen sey, “I koll my pikin komot from Egypt.”
16 Wen Herod si sey di wise men deceive am, e vex well-well, so e send sojas make dem go kill all di boys wey don rish two years kom down, bikos e don rish two years wen di wise men kom meet am sey, dem si di star. 17 Dis one make wetin Profet Jeremaya tok happen sey,
18 “Pipol hear kry and shaut for Rama.
Rashel dey kry for en pikin dem wey don die
and nor-tin wey pipol tok,
fit make en heart strong.”
Josef And En Family Go Back To Nazaret
19 Afta Herod die, God angel appear to Josef for dream wen e still dey Egypt, 20 kon tell am, “Make yu get up, karry di pikin and en mama go Israel, bikos di pesin wey won kill-am, don die.”
21 So, e karry di pikin and en mama go Israel back. 22 But wen e hear sey Arkelaus dey rule for Judea, afta Herod en papa don die, Josef kon fear to go der. Afta God don warn am for dream, e kon go Galilee. 23 Wen e rish Nazaret, e kon stay der. Dis one make wetin Profet Jeremaya tok happen sey, “Dem go sey Jesus, na Nazaret e from kom.”