3
John Di Baptist Message
For dat time, John di Baptist dey prish inside wildaness for Judea sey, “Make una turn from sin kom meet God, bikos God Kingdom don near.” Na dis John Profet Isaya tok about sey,
“One pesin dey shaut inside wildaness sey,
‘Make una make God road strait.’ ”
John wear klot wey dem use kamel hair make, e use leda belt tie waist and na lokust and honey for bush, e dey chop. Pipol from Jerusalem, Judea and all di town wey dey near Jordan River dey run go meet am and e kon baptize dem inside Jordan River, afta dem konfess dia sins.
But wen e si many Farisee and Sadusi pipol dey kom make e baptize dem, e kon tell dem, “Una, snake shidren! Who warn una about God judgement wey dey kom? Naw, make una do wetin go show sey una don turn from sin kom meet God, make una nor tink sey una don free bikos una sey, ‘Abraham na awa papa.’ Make I tell una, God fit turn all dis stone to Abraham shidren! 10 Naw sef, dem don put di axe for di tree bottom and any tree wey nor bear betta fruit, dem go kut am trow inside fire.
11 “I dey baptize una with wota make una for turn from sin kom meet God, but di pesin wey go kom afta, strong pass mi. I nor big rish to luz di rope wey dey en shoe, na-im go baptize una with Holy Spirit and fire. 12 Di fan wey e go take blow kanda komot from korn, dey en hand and e go gada and keep en korn inside store kon burn di dirty for faya wey nor dey kwensh.”
John Baptize Jesus Christ
13 Jesus kom from Galilee make John for baptize am for Jordan River. 14 But John won kon stop am sey, “Na yu suppose baptize mi, instead yu kom meet mi make I baptize yu?”
15 Jesus ansa, “Make e bi so naw, e betta make wi do evritin wey God wont.” So, John kon baptize am.
16 As Jesus dey kom out from di wota afta John don baptize am, heaven open and John kon si God Spirit wey bi like dove, stay on-top Jesus head. 17 Naim one vois from heaven kon sey, “Dis na My pikin wey I love and e dey make belle sweet mi.”