4
Devil Tempt Jesus Christ
Di Holy Spirit take Jesus go inside wildaness make devil for tempt am. Afta Jesus don fast for forty days and forty nites, e kon dey hongry. Den devil kon meet am sey, “If yu bi God pikin, kommand dis stone make e turn to bread.”
Jesus ansa, “God word sey, ‘Nor bi only food man go take survive, but na with evry word wey God tok.’ ”
Den, devil show Jesus di holy town kon make am stand on-top di place wey high pass for di temple and e tell Jesus, “If yu really bi God pikin, jump go down, bikos dem rite for God word sey,
“ ‘God go kommand en angels
make dem do evritin for yu
and dem go katch yu
make yor leg nor nak stone.’ ”
Jesus ansa am, “God word sey, ‘Make yu nor try God wey bi yor Oga God.’ ”
Den devil take Jesus go one mountin wey high well-well kon show am all di kingdom for dis world and all di betta tins inside am. Devil kon tell am, “I go give yu all dis tins, if yu go bow down woship mi.”
10 Jesus ansa, “Komot here, devil! Bikos God word sey, ‘Na only God wi suppose to serve and woship.’ ”
11 So, devil kon leave Jesus and God angels kon bigin help am.
Jesus Prish For Galilee
12 Wen Jesus hear sey dem don put John inside prison, e kon go back to Galilee. 13 From der, Jesus komot from Nazaret go Kapanaum wey near di sea, where Zebulun and Naftali pipol dey stay, 14 so dat wetin Profet Isaya tok, go happen:
15 “Zebulun and Naftali di place
where river for cross Jordan River go Galilee,
where pipol wey nor bi Jew dey stay,
16 una wey dey darkness,
don si big lite
and una wey don nearly die,
don get life.”
17 From dat time, Jesus bigin prish sey, “Make una turn from sin kom meet God, bikos God Kingdom don kom meet una.”
Jesus Choose En Disciples
18 As Jesus dey waka for Galilee wotaside, e si two brodas, Simon wey dem dey koll Pita and Andru en broda, dem dey trow net inside di river dey katch fish. 19 Jesus kon tell dem, “Make una follow mi and I go make una katch pipol.” 20 At wons, dem leave dia net kon follow Jesus.
21 As Jesus komot from der, e kon si two brodas, James and John, with Zebedee dia papa, dey ripair net inside dia boat. Den Jesus koll di brodas. 22 Kwik-kwik dem run leave dia papa inside di boat, kon follow Jesus.
Jesus Heal Pipol
23 Jesus kon dey waka for Galilee dey tish inside dia sinagog. E prish about God Kingdom and dey heal pipol wey get difren-difren diziz and doz wey nor well. 24 So di news about Jesus kon spread go evriwhere for Siria. Dem kon bring pipol wey nor well, wey nor fit waka, pipol wey devil dey worry and di pipol wey demon dey inside dem, kom meet am and e heal all of dem. 25 Many pipol from Galilee, Dekapolis, Jerusalem, Judea and pipol wey dey stay near Jordan River, kon follow am.