26
Dem Plan To Arrest Jesus
Wen Jesus tish finish, e kon tell en disciples, “Make una know sey na two days remain before di Passova go start and dem go give Man Pikin to pipol wey go nail am for cross.”
Di priest oga dem and di eldas kon whole meetin with Kaiafas, di High Priest, for en palis. Dem kon plan for sekret to arrest Jesus make dem for kill-am. But dem sey, “Make wi nor do am wen di Feast don start, so dat pipol nor go make trobol.”
Mary Pour Oil For Jesus Head
Naw, as Jesus dey Betany for Simon, wey bi leper, house, one woman bring kontaina wey get oil wey dear well-well kon pour di oil for Jesus head as e sidan for tabol dey chop.
Wen di disciples si wetin happen, dem kon vex well-well, ask di woman, “Why yu dey waste dis oil? E for betta sey dem sell am kon give di money to poor pipol!”
10 Wen Jesus hear wetin dem tok, e kon sey, “Why una dey trobol dis woman? Na betta tin e do for mi o-o! 11 Poor pipol dey with una evritime, but mi, I nor go dey with una always! 12 Wen di woman pour dis oil for my body, e dey prepare mi for my beri. 13 I tell una true word, anywhere wey dem go for prish dis gospel, dem go take dis tin wey di woman do so, take remember am for di whole world.”
Plan To Sell Jesus
14 Den Judas Iskariot, wey dey among di twelf disciples go meet di priest oga dem, 15 kon tell dem, “Wetin una go give mi, if I sell Jesus Christ give una?” So dem kon kount thirty silva koins gi-am. 16 From dat time, Judas kon dey find how e go take sell Jesus Christ.
Di Passova Feast
17 For di day wen dem start di Feast for di Bread wey nor get yist, di disciples kom meet Jesus Christ tell am, “Tell us where yu for won chop di Passova Food, so dat wi go-go prepare di place.”
18 Jesus tell dem, “Make una go inside di town and una go meet one man. Make una tell am, ‘Di tisha sey, “My time don rish. I go chop di Passova Food with my disciples for yor house.” ’ ” 19 So di disciples do as Jesus tell dem, den dem kon go prepare di Passova Food.
20 Wen evening rish, Jesus sidan for di tabol with en twelf disciples. 21 As dem dey chop, e kon sey, “I tell una true word, one of una go sell mi.”
22 Wetin e tok kon worry dem well-well, so dem kon bigin ask am, “Oga God, na mi?”
23 Jesus ansa dem, “Di pesin wey go put hand inside plate with mi, na-im go sell mi. 24 Man Pikin go die as dem rite about am, but curse dey di pesin head wey go sell am! E for betta sey dem nor born di pesin at-all.”
25 Den Judas, di pesin wey go sell am, kon sey, “True-true, Oga God, na mi yu dey tok about?”
Jesus ansa am, “Yu don tok am.”
God Supper
26 As dem dey chop, Jesus take bread kon tank God, afta e divide am, e give en disciples, kon sey, “Make una chop, dis na my body.”
27 Afta, e take di cup kon tank God, den e give dem kon sey, “Make all of una drink from am, 28 bikos dis na my blood, wey bi di kovenant wey go make God forgive pipol dia sins. 29 I tell una, from naw go, I nor go drink dis wine until di day wey I go drink di new wine with una for my Papa kingdom.”
30 Afta dem sing one hymn, dem komot kon go Mount Olives.
Jesus Sey Pita Go Deny Am
31 Den Jesus kon tell dem, “Dis nite all of una go run leave mi, bikos God word sey,
“ ‘I go kill di shepad
and di sheep go skata.’
32 But afta God don raiz mi up from deat, I go-go Galilee, go wait for una.”
33 Pita kon ansa am, “If odas run leave yu, mi, I nor go ever leave yu!”
34 Jesus kon tell am, “I tell yu di trut, for dis nite, before fawol go do ‘Kukuruku’, yu go deny mi three times.”
35 Pita still ansa, “Even if I go die, I nor go ever deny yu.” And all di disciples still tok di same tin.
Jesus Pray Inside Getsemani
36 Den Jesus go Getsemani with en disciples kon tell dem, “Make una sidan here bikos I wont cross go di oda side go pray.” 37 E take Pita, James and John, wey bi Zebedee two shidren, with am. But bikos of wetin won happen, belle nor sweet am. 38 Den e tell dem, “My heart heavy and e bi like sey I won die. Make una stay here and make una nor sleep.”
39 E waka go front small kon liedan face groun, den e kon pray, “My Papa, if yu wont, yu go fit remove dis deat from mi! But nor bi as I wont, na as yu wont am.”
40 Wen Jesus kom back, e kon si sey all en disciples dey sleep. Den e ask Pita, “So yu nor fit stay make yu nor sleep for one hour? 41 Open yor eye make yu pray, so dat yu nor go fall inside temptashon. Yor spirit won do am, but yor flesh dey weak.” 42 Jesus kon go pray for di sekond time, “My Papa, if yu nor won take dis deat komot unless I die, den make wetin yu wont happen.”
43 E kom back kon si en disciples dey sleep again; dem nor fit open dia eyes. 44 So e leave dem, go pray di same way for di third time.
45 Den e kon meet di disciples ask dem, “Una still dey sleep and rest? Si, di time don dey rish wen dem go sell Man Pikin give sinnas. 46 Make una stand up, make wi dey go. Si! Di pesin wey won sell mi, don dey kom!”
Dem Arrest Jesus
47 As Jesus still dey tok, Judas wey bi one of di disciples, kon kom. Plenty pipol wey di priest oga and eldas send, karry gun and big stik dey follow Judas for back. 48 (Naw, di pesin wey sell am, don give dem sign sey, “Di pesin wey I go kiss, naim bi di man. Make una arrest am!”) 49 At wons, Judas go meet Jesus, greet am kon sey, “Tisha”, den e kiss am.
50 Jesus tell am, “My friend, do wetin make yu kom.”
Den dem whole Jesus kon arrest am. 51 But one of di disciples wey dey with Jesus draw en swod kom out, kon kut di High Priest slave ear komot.
52 Den Jesus tell am, “Put yor swod for where e dey before! Bikos anybody wey dey karry swod, na swod go kill-am. 53 Yu tink sey, I nor fit koll my Papa sey make e send many angels kom help mi naw-naw? 54 But if I do am, wetin dem rite for God word about dis matter, nor go happen.”
55 By dis time, Jesus tell di pipol wey follow Judas kom sey, “Una karry swod and stik kon arrest mi like sey I bi tif? I dey tish inside di temple evriday, but una nor arrest mi.” 56 Dis one happen so dat wetin di profets rite for di book go bi true. Den all di disciples kon run leave am.
Di Sanhedrin Kondemn Jesus
57 Naw di pipol wey arrest Jesus take am go meet Kaiafas di High Priest, wey di law tishas and eldas don gada for en house. 58 But Pita follow dem go rish di High Priest yard. E kon sidan with di guards to si wetin go happen.
59 Di priest oga dem and di Sanhedrin kon dey find wetin dem go take whole Jesus, make dem for fit kill-am. 60 But dem nor si anytin to take hold am, even doh many pipol kom lie against am.
At last, two pipol kom out 61 kon sey, “Dis man sey, ‘I go fit distroy God Temple and build am again for three days’.”
62 So, di High Priest kon stand up ask Jesus, “Yu nor get any ansa? Wetin bi dis wey dem dey tok against yu so?” 63 But Jesus kwayet.
Den di High Priest kon tell am, “I take God name kommand yu to tell us if yu bi Christ, wey bi God Pikin.”
64 Jesus ansa am, “Yu don tok am. But I tell yu, from naw go, yu go si Man Pikin sidan for God rite hand dey kom down for kloud from heaven.”
65 Den di High Priest tear en klot kon sey, “E don tok against God! Why wi still nid anoda witness? Una don hear as e tok against God! 66 Wetin una tink?”
Dem kon ansa, “E do bad and e suppose to die.”
67 Dem kon spit for en face, beat am and some slap am, 68 dey sey, “Make yu tell us wetin go happen, yu wey bi Christ! Na who beat yu?”
Pita Deny Jesus Christ
69 As Pita sidan outside for di yard. One girl wey bi savant kon tell am, “Yorsef bin dey with Jesus Christ wey kom from Galilee.”
70 But Pita deny am for evribody front kon sey: “I nor know wetin yu dey tok about!”
71 Wen e komot go outside, anoda girl wey bi savant si am kon tell di pipol wey dey der, “Dis man sef dey with Jesus wey kom from Nazaret.”
72 Pita kon swear deny again, “I nor know di man!”
73 Afta sometaim, pipol wey stand for der, kom meet Pita tell am, “Yu really bi one of dem, even di way yu dey tok show sey yu dey with am!”
74 As e hear dis one, Pita kon dey swear, “I nor know di man!”
Dat same time, fawol kon make, “Kukuruku.” 75 Den Pita kon remember wetin Jesus tell am, “Before fawol go make ‘Kukuruku’, yu go deny mi three times.” So Pita go outside bigin kry.