27
Dem Take Jesus Go Meet Pilate
For early morning, di priest oga dem and di eldas kon dey plan as dem go take kill Jesus. Dem tie am kon take am go meet Pilate, wey bi di govnor.
Judas Kill Ensef
Wen Judas wey sell Jesus si sey dem kondemn am, en mind kon dey judge am for wetin e do, so e riton di thirty silva koins give di priest oga dem and eldas, kon sey, “I don sin as I sell dis innocent man make dem kill-am!”
But dem sey, “How dat one take koncern us? Na yor business bi dat.”
So Judas kon trow di silva koins inside di temple, den e komot go hang ensef.
Di priest oga dem take di money kon sey, “Moses Law sey make dem nor put blood money for di temple pus.” Afta dem don tok di matter, dem kon take di money buy one land wey di name bi “Potta Field” and na strenjas dem dey beri for der. Na bikos of dis make dem dey koll di land “Blood Field” kon rish today. So wetin profet Jeremaya tok kon happen: “Dem take thirty silva koins, di money wey Israel pipol don gri to take sell Jesus, 10 den dem use di money take buy, ‘Di Potta Field’, just as God tell mi.”
Jesus And Pilate
11 As Jesus stand for di govnor front, di govnor kon ask am, “Na yu bi di Jew pipol king?”
Jesus ansa, “Na as yu tok!”
12 Wen di priest oga dem and di eldas dey akuiz Jesus, e nor ansa dem. 13 Den Pilate tell Jesus, “Yu nor hear all di tins wey dem dey tok sey yu do?” 14 But Jesus nor ansa and di govnor kon sopraiz well-well.
15 For Passova Feast, di govnor dey always release one prisona give di pipol. 16 Dat time, e get one wiked prisona and en name na (Jesus) Barabas. 17 So, wen dem don gada, Pilate ask dem, “Who una wont make I release give una? (Jesus) Barabas or Jesus Christ?” 18 (Bikos Pilate know sey na jealousy make dem bring Jesus Christ kom meet am.)
19 As Pilate sidan for di judgement seat, en wife send message go meet am sey, “Nor put hand for dat innocent man matter, bikos last nite, I dream bad dream about am.”
20 But di priest oga dem and di eldas sey make di pipol ask for Barabas, so dat dem go fit kill Jesus Christ.
21 Di govnor kon ask dem again, “Wish one for dis two pipol una wont make I release give una?”
Dem ansa, “Barabas!”
22 So, Pilate kon still ask dem, “Den wetin I go do with Jesus wey dem dey koll Christ?”
All of dem kon ansa, “Nail am for cross!”
23 Pilate kon ask, “Why? Wish bad tin e do?”
But dem kon dey shaut more-more, “Nail am for cross!”
Sojas Kondemn And Laf Jesus
24 Wen Pilate si sey di pipol nor gri and trobol won start, e kon take wota wosh en hand for di pipol front dey sey, “Dis man blood nor dey my head. Make only una go kill-am!”
25 Di pipol ansa, “Make en blood dey awa head and awa shidren own!”
26 Den Pilate release Barabas give dem. Afta dem flog Jesus Christ, Pilate kon gi-am to dem make dem nail am for cross.
27 Di sojas take Jesus Christ enter di govnor house and all of dem kon gada am. 28 Dem remove en klot kon wear am klot wey make am bi like king. 29 Dem take shuku-shuku make crown wear am for en head, put walkin stik for en hand, den knee down for en front kon dey laf am dey sey: “Make una hail Jew pipol king o-o!” 30 Dem spit for en body kon take walkin stik nak en head many times. 31 Wen dem laf am finish, dem remove di king klot wey dem wear am kon wear am en own klot. Den dem take am go nail for cross.
Dem Nail Jesus For Cross
32 As dem dey go outside, dem si one man from Sirene wey en name na Simon and dem kon force am make e karry Jesus Christ cross. 33 Wen dem rish one place wey dem dey koll Golgota (wey mean “Skull Place”), 34 dem kon give Jesus Christ betta wine make e drink. But wen e taste am, e nor gri drink am. 35 Wen dem don nail am for cross, dem kon gambol take divide en klot. 36 Dem sidan der dey look make anybody nor tosh am. 37 On-top of en head for di cross, dem rite wetin dem take akuiz am: “Dis na Jesus Christ, Jew pipol king.” 38 Dem still nail two tif near Jesus Christ for cross, one for en rite and di oda for en left hand. 39 So di pipol wey dey pass where Jesus Christ dey kon dey laf am and dey shake dia head 40 dey sey, “Yu wey sey yu go distroy di temple kon build am back for three days, make yu save yorsef! If yu really bi God Pikin, make yu kom down from di cross!”
41 Na like dis too, di priest oga dem, di law tishas and di eldas dey laf am sey, 42 “E save oda pipol, but e nor fit save ensef! If e kom down naw from di cross, wi go bilive sey, na-im bi Israel King! 43 Since e trust God, make God kon save am naw, bikos e sey, ‘I bi God Pikin!’ ” 44 Di tifs wey dem nail for cross near Jesus Christ, still dey curse am too.
Jesus Die
45 E kon happen sey, from twelf go rish three oklok for aftanoon, darkness kon kover di whole land. 46 Wen three oklok won rish, Jesus Christ kon shaut, “Eli, Eli, lema Sabaktani?” wey mean, “My God, My God, wetin make yu abandon mi?”
47 Some of di pipol wey hear di word kon sey, “Dis Man dey koll Elijah make e kom help am.”
48 At wons, one of dem run go bring sponge kon soak am for wine wey don sawa, put am for stik, den kon give Jesus make e drink. 49 But di remainin pipol sey, “Leave am! Make wi si weda Elijah go kom save am.”
50 So Jesus Christ kry again, den e kon die.
51 At wons, di temple kotton tear from up go rish bottom. Di groun bigin shake and rocks kon skata for evriwhere. 52 Graves open and God pipol wey don die kom wake-up. 53 Afta Jesus raiz from grave, God pipol wey don die follow am raiz, den dem kon enter di holy Town with am and many pipol si dem.
54 Wen di sojas oga and di pipol wey dey guide Jesus Christ si di eartkweke and wetin happen, dem fear well-well kon sey, “True-true dis man na God Pikin.”
55 Many wimen wey follow Jesus Christ from Galilee and wey dey help am, dey der too. Dem dey look wetin dey happen for der. 56 Mary Magdalin, Mary, wey bi James and Josef mama and Zebedee shidren mama, dey der too.
Jesus Christ Burial
57 Wen evening rish, Josef, one rish man from Arimatea, wey bi Jesus Christ disciple 58 go meet Pilate kon ask am for Jesus Christ body. So Pilate kon sey make dem gi-am di body. 59 So Josef karry di body kon wrap am with klean white klot. 60 E put am inside en own new grave wey e dig inside rock. Den e roll one big stone kover di grave mout. 61 (Mary Magdalin and di oda Mary sidan for di oda side wey face di grave).
Pipol Wey Dey Guide Di Grave
62 Di next day (wey bi Sabat Day) di priest oga dem and di Farisee pipol kon gada for Pilate front 63 dey sey, “Oga God, wi remember sey wen dat wayo man still dey for dis world, e tok sey, ‘Afta three days, e go wake-up.’ 64 So make yu give orda make dem guide di grave until di three days go rish. If not, en disciples go-go tif en body kon tell pipol sey, ‘E don wake-up from deat’ and dis go make di last wayo worse pass di first one.”
65 So Pilate tell dem, “Make una take plenty sojas go guide di place as una wont.” 66 So dem karry sojas go guide di grave and dem kon block di grave mout, so dat Jesus Christ nor go fit kom out.