28
Di Resureshon
Wen day break for Sabat Day, wey bi di first day for di week, Mary Magdalin and di oda Mary kon go look di grave.
At wons, strong eartkweke happen, bikos God angel kom down from heaven, roll di stone komot kon sidan on-top am. En face bi like tonda lite and en klot white like snow. Di guards kon dey shake and dem bi like pipol wey won die, bikos fear katch dem well-well.
But di angel tell di wimen, “Make una nor fear, I know sey una dey look for Jesus Christ, wey dem nail for cross. E nor dey here, bikos God don wake am up, just as God promise. Make una kom si di place where e liedan put before. Den make una kwik-kwik go tell en disciples sey, ‘God don raiz am from deat and e dey go wait for una for Galilee. Una go si am for der.’ Make una remember sey I tell una so!”
So dem run komot from di grave with fear and dem kon dey happy as dem dey go tell en disciples. But Jesus Christ meet dem for road kon tell dem, “I greet una o-o!” Dem dress near am, hold en leg kon woship am. 10 Den Jesus Christ tell dem, “Make una nor fear, but tell my brodas make dem go Galilee and dem go si mi for der.”
Di Sojas Ripot
11 As dem dey go, some for di guards go inside di town go tell di priest oga dem evritin wey happen. 12 Afta dem don gada and plan with di eldas, dem kon give di sojas plenty money, 13 kon tell dem sey, “Make una tok sey, ‘Jesus Christ disciples kom tif en body for nite wen wi dey sleep.’ 14 If di govnor hear about dis matter, wi know wetin to tell am and una nor go enter trobol.” 15 So dem take di money kon do as di eldas tell dem. Pipol still dey tok dis story for evriwhere wey Jew pipol dey, kom rish today.
Di Big Message
16 So di eleven disciples kon go Galilee for di mountin wey Jesus Christ tell dem. 17 Wen dem si am, dem woship am, but some among dem kon dey doubt. 18 Den Jesus Christ waka near kon tell dem, “God don give mi all di pawa wey dey heaven and eart. 19 So make una go make pipol my disciples for di whole world, dey baptize dem with di Papa, di Pikin and di Holy Spirit name, 20 dey tish dem to do evritin wey I tish una. I go always dey with una until di world go end.”