114
Passova Song
Wen Israel pipol komot from Egypt;
wen Jakob family komot from di land where dem for bi strenja,
Judah kon bi God temple
and Israel kon bi en kingdom.
Di Red Sea si dem dey kom,
kon run and Jordan River turn en face.
Di mountins jump like goat
and di hills run like lamb.
Red sea! Na wetin make yu dey run?
Jordan River na wetin make yu turn yor face?
Yu mountins, wetin make Yu jump like goat?
Yu hill, why Yu run like lamb?
Yu, eart make yu shake with fear,
bikos of di Oga wey bi Jakob God,
wey turn strong groun to where wota full
kon bring wota kom out from strong rock.