115
Di One And Only True God
My God! Nor bi wi get di glory!
Nor bi wi, but make all glory bi yor own,
bikos of yor faithfulnes and love wey nor dey fail.
Why Yu dey let di nashons sey,
“Where dia God dey?”
Awa God dey for heaven
and E dey do wetin E like.
Na silva and gold human being
take make dia juju.
Di juju dem get mout, but dem nor fit tok;
dem get eye, but dem nor dey si.
Dem get ear, but dem nor dey hear,
dem even get nose, but dem nor fit smell anytin.
Dem get hand, but dem nor fit tosh or feel anytin.
Yes! Dem still get leg, but dem nor fit waka.
Dem even get trot, but dem nor fit klear am or make any sound.
Pipol wey dey make juju and all doz wey trust dem and di juju,
bi like di juju wey dem make with dia own hand.
So, Israel pipol, make una trust God,
bikos na-im dey help and guide una.
10 Una wey bi priests, Aaron shidren-shidren,
make una trust God, bikos na-im dey help and protet una.
11 All of una wey dey obey God, make una trust am,
bikos na-im dey help and guide una.
12 God go remember and bless us.
E go bless Israel pipol and di priests
wey bi Aaron shidren-shidren.
13 E go bless di pipol wey dey obey am;
both small and big.
14 Make God really make una plenty;
both una and una shidren.
15 Make God wey make heaven and eart,
bless una.
16 Na God get di heavens,
but E don give di eart to human being.
17 Pipol wey don die nor fit sing praiz God,
bikos dem don die enter dia grave wey kwayet.
18 But wi go praiz God both naw and forever!
So make wi praiz di Oga wey bi awa God!