116
Man Wey God Save From Deat
I love God, bikos E dey hear my vois
and my prayer for help.
E dey listin to mi, so as long as I dey alive,
I go dey pray to am to help mi,
bikos deat kover mi like klot and di fear to die go grave,
dey make mi shake.
Na only sorrow and trobol I dey si.
So I koll God name:
“Oga God, abeg make Yu kom save mi!”
Naw, make una si as God kind and good rish!
Dis awa God too dey pity for pesin!
God dey protet pipol wey dia faith neva too strong and even wen I dey face deat,
E kom save mi!
So my soul go rest again,
bikos God dey good to mi.
Yes! E save mi from deat kon remove tears from my eyes,
so dat I nor go fall.
I dey waka for God present
as I dey for dis world!
10 I get faith wen I sey,
“My God, I bilive Yu,
even doh my mind really dey trobol mi.”
11 As I dey vex, I kon sey,
“Evribody dey lie well-well!”
12 So, wetin I go give God for evritin
wey E don do for mi?
13 I go dance bikos E diliver mi
kon praiz God name forever.
14 I go keep my promise
wey I make to God for en pipol present.
15 God dey kare for en pipol and E dey pain am well-well
wen di ones wey E love, dey die.
16 My God, I bi yor savant;
yes, I bi yor savant wey dem born for yor house
and Yu don free mi from di shains
kon save mi from deat.
17 So I go tank God with sakrifice
kon pray to am.
18 Na for pipol present I go for
do wetin I vow to God
19 and na for God house wey dey Jerusalem.
So make wi praiz di Oga wey bi awa God!