121
Na God Dey Protet
David Song
I go look up to di mountin!
Where my help from dey kom?
My help dey kom from God,
di Pesin wey make heaven and eart!
E nor go let mi kick stone fall;
di Pesin wey dey guide mi nor dey sleep.
True-true, di Pesin wey dey guide Israel
nor dey sleep at-all at-all.
Na God ensef dey wosh ova mi!
E stand near mi kon protet mi.
Di sun nor fit do mi anytin for day time
or di moon for nite.
God dey keep mi from my enemies
and E dey protet my life.
God dey always protet mi both wen I go out and wen I dey kom back!
E go protet mi naw and forever.