122
Praiz Jerusalem
David Song
I happy well-well wen dem sey,
“Make wi go God house.”
And na der wi dey naw,
as wi stand inside Jerusalem.
Jerusalem na strong town wey dem build well;
so nor-tin go fit skata en wall.
Israel wey bi God pipol, all en tribes dey go der go woship am.
Just as Israel law tok, dem dey kom give God tanks for der.
Di throne where God for dey judge kase dey for der;
di throne wey bi David and en shidren-shidren own.
So make una pray for peace for Jerusalem and evribody wey love am,
go prosper.
My Jerusalem, make peace follow yu
and yor palis go dey prosper forever.
Bikos of my family and friends, I go sey,
“Make peace follow yu.”
Bikos of awa Oga God house,
I go pray make Jerusalem dey prosper.