123
Prayer For Mesi 
 
David Song 
 
1 My God wey dey heaven,  
na Yu I dey depend on.   
2 Just as savants dey depend on dia masta  
and as savant girls dey depend on dia madam,  
na so wi too dey depend on di Oga awa God, until E go favor us.   
3 My Oga God, make Yu sorry and pity for us,  
bikos wi too don get awa own share for di trobol.   
4 Di wahala wey wi get,  
don taya us and awa trobol, plenty well-well.