124
Na God Dey Protet En Pipol 
 
David Song 
 
1 Make Israel pipol sey,  
“If to sey Oga God nor dey awa side?”   
2 If to sey God nor really dey awa side  
wen pipol attack us,   
3 dem for don swallow us  
alive as dem dey vex.   
4 River for don kover us;  
wota for don karry us go.   
5 Strong wave for river  
for don kover awa soul.   
6 So, make wi praiz God  
wey nor let awa enemies tear us to pieces with dia tit!   
7 Wi don eskape like bird  
wey komot from hunta trap.  
Dia trap and net wey dem set for us,  
don break and wi don dey free!   
8 God wey kreate heaven and eart,  
na-im diliver us from dia hand.