125
God Pipol Dey Save 
 
David Song 
 
1 Pipol wey trust God dey sikure like Mount Zion;  
nobody go fit bend dem and dem go dey forever.   
2 Just as mountin gada round Jerusalem,  
na so too God dey round en pipol,  
both naw and forever.   
3 Wiked pipol nor go rule pipol wey dey fear and obey God,  
if not, doz wey dey obey God fit start to do bad tins too.   
4 My God, make Yu do good to pipol wey dey good;  
doz wey dia heart and mind dey with Yu,   
5 but make Yu ponish pipol wey dey do bad tins.  
Ponish dem with all di oda wiked pipol.  
Make peace always dey Israel land!