127
God Goodness
Solomon Song
Unless God build house,
di pipol wey dey build am,
just dey waste dia time.
Unless God guide town,
doz wey dey guide am, nor go fit protet am.
E dey yuzles to work hard from morning go rish nite,
bikos of wetin yu go chop.
Yes! God dey provide for di pipol wey E love,
even wen dem dey sleep.
Yes! Shidren na God gift;
dem bi reward from awa Oga God.
Pikin wey yong man born,
strong like arrow for warrior hand.
Na dem bi di main rizin wey make man dey happy
and shame nor go katch di man
even wen e meet en enemies for di town gate.